You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Theresa May resigns: British Prime Minister cry tears wen she decide to step down on June 7
British Prime Minister Theresa May use Friday announce say she dey resign her post on June 7 sake of di BREXIT wahala
Dis dey come as she don receive pressure to leave office sake of her deals to cari UK comot from European Union alias Brexit.
Tori be say na three times her BREXIT bill don fail before parliament, wey mean say she don fail.
Theresa May wey be di second UK Prime Minister afta Margaret Thatcher cry tears wen she resign as British Prime Minister.
For inside speech di British Prime Minister, Theresa May tok say she go always regret say she no deliver Brexit even as she announce her resignation wey go hold on June 7
Madam May tell tori pipo say di process to pick di next Prime Minster go happun on week afta she comot
According to local tori, madam May enta meeting on Friday morning wit Sir Graham Brady, wey be chairmo of di influential 1922 Committee of Conservative backbench MPs.
Dis meeting na for oga Graham to tell di UK Prime Minster say as tins be unless she use her hand resign, di members of parliament no go get choice to pass vote of no confidence against her, meaning say dem fit sack her from 10 Downing Street.
End of Di one wey oda users dey read well well
BBC News Pidgin dey follow di tori... more updates go follow, make you just refresh the page.
Theresa May career inside foto
Theresa May say she go resign as Conservative leader on 7 June, to make way for contest wey go decide new UK prime minister.
For her byebye message wey she bin cry ontop, she say to serve na honour for her and she dey proud to be di second female leader of di UK.
From her early days as di MP for Maidenhead to her position as Home Secretary for David Cameron goment, we don use foto to show how her political career don be.
For here, May dey give victory speech when dem elect her as MP for Maidenhead for Berkshire for May 1997, wey bi seat she never comot from since dat time.
For di early days of her career, photographers dey always dey interested for di kain show wey May don wear.
For di foto above, she dey show di shoe for di 2004 Conservative Party Conference for Bournemouth, when she be di Shadow Secretary of State for di Family.
Dem appoint May as home secretary for 2010 when di Conservatives join wit di Lib Dems to form di first coalition goment in 70 years.
As home secretary, May shock di annual conference of di Police Federation for 2014 wen she tell dem say di corruption problems no dey just limited to "a few bad apples" and threaten to end di federation automatic right to employ officers as members.
For 2019, dem criticise am afta she insist say "no direct correlation" no dey between rise of violent crime and di cut down of police money during her time as home secretary.
Afta David Cameron resignation as Prime Minister and di result of di EU referendum, May win di Conservative leadership contest for July 2016, when 199 MPs bak am for di second ballot.
Queen Elizabeth II invite May to form new goment on 13 July 2016, to make her di kontri second ever female Prime Minister.
May and her husband Philip dey here dey wave to di media for 10 Downing Street on di day she enta office as prime minister.
For January 2017, May begin two-day visit to di US and she become di first world leader to meet President Donald Trump.
Di two of dem bin hold hand for short time as dem waka down one road for White House, and later di foto of am make headlines around di world.
Following denial say she go call for snap election, May call one for April 2017, wey dem go do for 8 June.
May begin do election campaign wit di slogan: "Strong, stable leadership for di national interest". She chose to call di election to try and get strong support for her tok tok wit di EU ontop Brexit.
When she dey campaign for Mevagissey, Cornwall, Photographers snap May as she dey chop chips, wey make popular memes comot for social media.
After two months of campaigning, di results of di snap general election led make di Conservatives to lose dia majority. Di election defeat turn to humiliation for May, wey make opposition Labour leader Jeremy Corbyn to ask her to resign, but she tok say her party go "ensure" stability for di UK.
On 14 June 2017, May bin face di tragedy of di Grenfell Tower fire, London wey kill 72 pipo. For her, she dey follow Dany Cotton, Commissioner of di London Fire Brigade tok, for where di fire bin happun.
For di Conservative Party annual conference for Manchester for October 2017, protester comedian Simon Brodkin give May one piece of paper wey dem write to resemble P45 (employee leaving form).
May look like say she dey lonely for dis popular foto of her, when she bin dey wait for di bilateral meeting wit European Council President Donald Tusk during one EU summit for Brussels in October 2017.
Di following year, May enta news headlines when she dance ontop stage to Dancing Queen song by Abba for di Conservative Party Conference for Birmingham for October 2018
On 14 November 2018, May follow meet wit di different different ministers for Downing Street to brief dem on di 585-page EU withdrawal agreement, afta months of negotiations.
MPs suppose vote ontop May Brexit deal for December 2018, but she sef gree say "many pipo go reject di deal", so she postpone am in order to return to Brussels to ask for changes.
On 13 March 2019, MPs vote for di deal di second time, wey dem reject again, for time wey na just 17 days remain till di deadline to leave di EU. May also lose di third vote.
Following di announcement say she go step down, leadership contest inside Conservative Party to decide who go be di next prime minister go begin, while di UK torchlight wetin go happun next wit Brexit.
Next chapter na to see wetin go happun next wit Brexit.