New Zealand Mosques: 49 pipo don die inside attack for Christchurch

Wia dis foto come from, Reuters
49 pipo don die inside terror attack for Christchurch, New Zealand.
Police for New Zealand confam say di pipo die afta attacks ontop two mosques for di city of Christchurch.
According to di kontri Prime Minister Jacinda Arden, three men and one woman dey custody no dey di active watchlist but police dey question dem.
Pipo wey take eye see how e happun tell tori pipo say dem run for dia lives and say dem see pipo dey bleed for ground outside for Al Noor mosque.
Authorities don advise say make every mosque shut down until further notice. All schools for Christchurch too dey on a lockdown.

Wia dis foto come from, Google
Prime Minister Jacinda Arden don address di nation say although di details of di shootings never clear yet, but she fit say "e go be one of di darkest days for New Zealand."
Video wey dey circulate wey e be like say di shooter feem dey suggest say im dey video di tin as e dey shoot di victims.
One survivor don also tell New Zealand TV say say im see one gunman shoot pesin directly for chest. Im tok say 60 pipo fit don injure for di attack.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say di gunman first target di men prayer room before im move go di women own for di mosque.











