New Zealand: Jacinta Arden don get belle

Wia dis foto come from, Getty Images
New Zealand Prime Minister Jacinda Ardern don announce say she get belle.
Ms Arden talk say she and her partner, Clarke Gaford dey expect dia first pickin for June after which she dey plan go fir six weeks leave.
She write for post for social media say she bin think say 2017 na big year.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Dis na for October, as she win election to become di youngest Prime Minister at 37 years.
For di post she announce say her husband go be stay-for-house papa.
For her first interview as head of her party for July 2017, she answer one journalist whether she go wan born pickin or get career, say di fact say woman get pickin no go mean say she no go fit do her work well and "no be better question to dey ask for 2017".







