Jussie Smollett get case for im head as im lie give us - Police

Jussie Smollett

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Na im be Jamal Lyon for di Empire feem
Read am in 1 mins

Police for Chicago don charge American actor Jussie Smollett say im write lie-lie police report.

Di star of di TV show Empire, tok say two men beat am for January because im be black and gay.

Pipo start to look di tori one kain wen American media report say im fit don pay two brothers to plan di attack.

Oga Smollett lawyers say dem go conduct serious investigate on top di mata and go defend am well.

On Wednesday tok tok pesin for police say dem don approve criminal charge against di actor.

Police tok-tok pesin Anthony Guglielmi tweet say dem don charge Smollett for "disorderly conduct/filing false police report."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Im add say dem dey follow Smollett lawyers tok to see how dem fit arrest am.