You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Offset crash Cardi B show to beg her and pipo dey para
Fans of Cardi B dey para afta her husband Offset crash enta her show on Saturday, to beg her to take am back.
Cardi B bin dey perform for Rolling Loud festival show for Los Angeles, California, wen Offset show wit big flower and banner wey im write 'take me back'.
Offset also collect microphone, begin beg her, but Cardi B no shake, and e be like wetin im do no sweet her belle. She bin announce earlier dis month say di two of dem dey separate, say "love don finish for dia side."
Her fans for social media no like di 'stunt' wey Offest do for di event, and many of dem dey blame di organisers say why dem allow to show.