Priyanka Chopra: Bollywood actress wedding cloth to Nick Jonas long like say tomorrow no dey

Wia dis foto come from, EPA
Bollywood star, Priyanka Chopra wey marry US singer Nick Jonas for Rajasthan state over di weekend, don show di world her ogbonge wedding dress for her Instagram post on Wednesday.
Di dress wey designer Ralph Lauren do, get more than two million mother-of-pearl sequins wey dem sow inside, but na di veil be di ogbonge serere wey wey make pipo eye big.
Jonas and Chopra engage for summer afta dem begin date no too long.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1

Normally, di internet get plenti tins to tok about her veil, wey dey very big so tey e need small team of pipo to carry am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

And some pipo even do some kain comparisons.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3

Chopra wear di Ralph Lauren dress wey dem use hand bead for di ceremony on Saturday for di lawn of di Umaid Bhawan Palace inside di City of Jodphur.
Na Jonas papa wey be pastor, Paul Kevin Jonas officiate for di ceremony.
Chopra tell People Magazine, say di wedding na "religious mash-up", she add say dem "take beautiful traditions wey we both take grow up with and personalise dem in a way wey make sense for us".
End of Di one wey oda users dey read well well
Di couple three-day ogbonge wedding extravaganza also include traditional Hindu ceremony on Sunday, wey dem for take exchange vows again.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2

Jonas, wey be 26 years old, and Chopra, wey be 36 years old, engage for summer, not long afta news of dia romance enta public.
Dem bin tok for one interview say dem first start to dey exchange texts for September 2016. Two of dem appear togeda for di Met Gala for May 2017.
Chopra na one of Bollywood highest-paid actress, she don win di Miss World pageant for 2000 and don act for more than 50 films for India.
She enta inside acting for US wit one part for di TV series Quantico and film roles inside Ventilator, Baywatch and A Kid like Jake.