Cameron Underwood: New face mean say I fit smile again

Cameron Underwood

Wia dis foto come from, NYU Langone Health

Read am in 2 mins

Cameron Underwood say strangers no dey too look am or ask kweshun again since im get new face.

"I get nose, mouth, so I fit smile, tok and chop solid food again," im tok.

Cameron dey tok two years afta im shoot imsef as im try to kill imsef for 2016.

Im loss im nose, most of im lower jaw and remain only one teeth for wetin happun.

"I dey very happi to get face transplant because e give me second chance for life," di 26-year-old tell tori pipo for New York on Thursday.

"I don begin do tins wey I like, like to dey outside, do sports and spend time with my friends and family.

"I hope say I go begin work very soon and one day I go start family."

Cameron Underwood and family

Wia dis foto come from, Underwood family

Wetin we call dis foto, Cameron, wey dey for right, wit family members for New Year's Day for 2016

For January dis year, more than 100 medical staff do 25-hour surgery on Cameron for di NYU Langone Health centre for Manhattan, New York, and na last week im show face since im recover.

Since di first face transplant for 2005, dem don do more than 40 worldwide.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Presentational white space

'My pikin dey helep Cameron live beta life'

Cameron Underwood, Sally Fisher, and Eduardo D. Rodriguez,

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sally Fisher, di mama of Will wey donate im face, say she for fit no survive as her pikin die, if not for Cameron.

Di pesin wey donate face dem use na 23-year-old Will Fisher, wey be chess champion, pesin wey wan be writer and filmmaker.

"My pikin death na bad thing," im mama Sally tok.

"I no tink say I for fit survive as Will die if not for Cameron. Cameron get plenti life wey remain - and I happi say Willie dey help am get beta life," she tok.

Will Fisher

Wia dis foto come from, Fisher family

Wetin we call dis foto, Will na pesin wey register to dey donate organ donor from im bodi before im die