Guava Island: Rihanna & Childish Gambino new film trailer leak, see wetin pipo dey tok

Read am in 2 mins

Di trailer for di feem wey Rihanna and Donald Glover (Childish Gambino) do, wey dem call Guava Island leak enta social media on Monday afta dem premiere am for Donald Glover Festival wey e call Pharos.

Di movie show di two artistes dey act as couple wey wan blow for 'Paradise' and na di same director wey do Childish Gambino "This is America", Hiro Murai direct dis one.

As di trailer end e be like say Black Panther "Shuri", Letitia Wright and British Nigerian avctor,, Nonso Anozie go also follow show for di movie.

No be di first time, di Barbados pop star and fashion business woman dey show for inside feem as she follow act for Ocean 8, wey be di latest feem for di series of US tiff tiff feems.

Wetin pipo dey tok about Rihanna & Childish Gambino new film