Comedy Wildlife Photography Awards 2018: Squirrel wey shock and oda funny foto dem dis year
One foto of squirrel wey shock don win di overall prize for dis year Comedy Wildlife Photography Awards.
Out of thousands wey send dia pishure enta di award from around di world, Mary McGowan, from Tampa, Florida, win wit her foto wey she title: Caught in di Act.
See some of di funny foto dem wey win and di ones dem clap hand for say dem try wella.
Winning foto dem
Wia dis foto come from, Mary McGowan/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Mary McGowan foto of squirrel wey shock na di overall winner. E also win for di People's Choice and Creatures of di Land awards
Wia dis foto come from, Shane Keena/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Shane Keena win di Creatures of di Air prize wit dis foto of owl
Wia dis foto come from, Tanya Houppermans/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Smile for di camera! Tanya Houpperman win di Under di Sea category wit dis foto of shark wey dey shine teeth
Wia dis foto come from, Arshdeep Singh/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Dis owl for Kapurthala, India, win Arshdeep Singh di Junior Award
Wia dis foto come from, Valtteri Mulkahain/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Valtteri Mulkahainen win di Amazing Internet Portfolio category wit pishures of family of brown bears for Finland
Foto dem wey receive accolades
Wia dis foto come from, Kallol Mukherjee/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Dis rhino wey dey like e wear peacock-feather tutu for Kallol Mukherjee na for Gorumara National Park, India dem snap am
Wia dis foto come from, Danielle D'Ermo/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Dis bear wey dey vex na Danielle D'Ermo snap am for Alaska
Wia dis foto come from, Roie Galitz/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Roie Galitz site dis ogbonge photographer for Svalbard
Wia dis foto come from, Geert Weggen/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Geert Weggen snap dis red squirrel wey dey do splits for Sweden
Wia dis foto come from, Barney Koszalka/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Moose wey Barney Koszalka snap for Wyoming, US
Wia dis foto come from, Sergey Savvi/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Two lizards wey dey like dem dey dance for Wilpattu, Sri Lanka. Na Sergev Savvi snap am
Wia dis foto come from, Sergey Savvi/CWPA/Barcroft Images
Wetin we call dis foto, Sergey Savvi also snap dis two dusky leaf monkeys wey be like dem dey do chaki chan for Kaeng Krachan National Park, Thailand
Di Comedy Wildlife Photography Award dey release book, wey dey help support di Born Free Foundation charity.