Orange Is The New Black film go end wit season fans 'no go ever forget'

Wia dis foto come from, Netflix
Award winning Nigeria-American actress Uzo Aduba wey play 'Crazy Eyes' for Netflix Orange Is The New Black feem don give assurance say di last season of di feem na one wey dem no go ever forget.
Netflix announce Wednesday say Orange Is The New Black wey be one of dia ogbonge TV show, go end final-final for 2019.
Di award-winning comedy drama series wey dey based on women inside prison go pack up afta di new season 7 wey dey come July 2019.
Inside one video for di show official Twitter account, some of di show actors like Nigeria-American actor Uzo Aduba wey play Suzanne "Crazy Eyes" Warren and Danielle Brooks wey play Tasha "Taystee" Jefferson, promise say di last season of di show go tortori dia fans well-well.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di show first launch for 2013 and e don dey very successful, as e don win plenti Emmy and Screen Actors Guild awards.
Aduba hersef, wey her parents be Nigerians from Igbo tribe, don come from time wey pipo no too sabi am to wia she get pass 500K followers on top Twitter.
Today, she fit boast of two Emmy Award (2014 and 2015) and Screen Actors Guild Awards (2014 and 2015) - di first pesin of Nigerian heritage to get dat kain accolade.
OITNB na Netflix popular show.
Orange Is the New Black aka OITNB series television show wey Jenji Kohan bin do for streaming service Netflix na feem wey dey based on di experience wey one woman wey her name na Piper Kerman bin get inside FCI Danbury, a minimum-security federal prison.
End of Di one wey oda users dey read well well
For 2010, she launch her book 'Orange Is the New Black: My Year in a Women's Prison' wia she tok about wetin her eye see for di prison.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
E no too tey wey Netflix, di owner of di show, buy di rights to Lionheart wey be feem by Nigerian actress Genevieve Nnaji as part of di $8 billion money dem don comot to take torchlight original productions.
Netflix bin don license some Nollywood feem before like romantic comedy The Wedding Party and October 1 by Kunle Afoloyan but dat na afta di feems don play for Nigerian cinema.
Orange Is The New Black Season 7 go launch on Netflix from July 2019.












