You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Will Smith use helicopter bungee jump celebrate im 50 years birthday
Will Smith celebrate im 50 birthday on Tuesday with family and friends but e no really cut cake instead im do bungee jumping.
Bungee Jumping na wenpesin connect rope with something come fall down dey bounce like basketball. Will Smith do im own with rope wey dem connect with helicopter.
Di move to do am with helicopter make am dangerous because di helicopter still dey move as di pesin dey bounce.
E bin post di test wey dem bin use doll baby do and di doll leg bin comot wey scare pipo like mad.
E do dis ogbonge stunt in front of im wife, Jada Pinkett Smith and former wife, Sheree Fletcher and im three pikin, Trey, Jaden and Willow and oda pipo wey include im former co-star for "Fresh Prince of Bel-Air", Alfonso Ribeiro.
E also post anoda video wey im watch how e take fall for di bungee jump.
Will Smith use di bungee jump to make pipo to sabi di charity joinbodi Global Citizen wey wan end extreme poverty by 2030.
Na one joinbodi wey dem call "Yes Theory" bin dare am to do di bungee jumping
End of Di one wey oda users dey read well well
Pipo don start to dey tok on top di mata.
Dis pesin no understand wetin Carlton dey find for dia.
Dis pesin no dey happy say Will Smith no use di Hilary line for im jump.
Dis pesin tok say wetin Will Smith do for im birthday na birthday goals.