Why di fight between R Kelly and im broda don enta phase two

R Kelly

Wia dis foto come from, Getty Images

Popular singer R Kelly don enta news again afta im broda fight plenti accuse give am.

For interview wey Carey 'Killa' Kelly give tori pipo 'unWinewithTashaK,' e claim say im broda fit don do somtin wit dia 14-year-old cousin.

R Kelly neva chook mouth for di mata.

Carey Kelly say e be like dia mama death for 1993 and singer Aaliyah death for 2001 fit don affect im brother, say di singer too dey go afta young girls.

E say e fit be sake of say dem molest R Kelly wen e small na im make e dey behave dat way.

"Dem molest me and my broda wen we dey small, but I no end up like am." Na so Carey tok.

R Kelly 25 years music career get plenti sex abuse case wey dey follow am for back and na underage pikin e dey get mata wit.

Carey Kelly bin don release one album wey e yab im broda say e too dey follow small small girls.

R Kelly release song for July wey im title "I admit". E use di song tok plenti tins about di accuse wey pipo dey sama am ontop sex abuse, but e say im no still suppose go prison for all di accuse.