American Senator John McCain don die

U.S. Senator John McCain (R-AZ) speaks after being awarded the 2017 Liberty Meda

Wia dis foto come from, Reuters

American Senator John McCain wey stop im cancer treatment on Friday don die.

Di Vietnam war hero wey later become senator and presidential candidate for America die on Saturday for age 81.

Oga McCain family bin dey by im side wen e die, according to statement wey im office give tori pipo.

n Photopress Agency

Wia dis foto come from, EPA

Praises from world leaders, politicians and celebs dey pour for former American Vietman war hero John McCain.

Former American presido Barrack Obama say Senator McCain na man of big courage wey like to see America as place wey anything dey possible.