Doctor don comot teeth of 12 days old pikin

Dentist for UK don comot di tooth of one 12 days old baby girl, Isla-Rose wey carry teeth come world wen dem born her.

Isla-Rae mama, Heasman tok say she no expect to cari her small pikin go dentist. "We just need to comot di tooth because e dey shake. She get mind pass me, she no really cry," she tok.

Di Seven Trees Dental Access Centre for UK say Isla-Rae na di youngest pikin dem don see wey get teeth. Most pikin dey begin get teeth from wen dem dey around 4-6 months and odas dey even reach 1 year sef.

Her mama, Heasman say she cry comot for di room as she no get mind to see her baby inside pain. She add say e dey strange now wey her baby no get teeth again.

According to di BDA, about one in 2000 pikins dey come world wit teeth but e no dey strong. Sabi pipo say di condition fit cause wahala with breast feeding, tongue ulcer and di teeth fit even enta di pikin lungs but dat na for extreme cases.