Venezuela President say na Africa win di world cup

Wia dis foto come from, Reuters
Venezuela President, Nicolas Maduro say na Africa win di football World Cup for France, and so make Europe end discrimination against immigrants.
President Maduro tok dis one for di capital, Caracas and dia state television quote wetin im tok:
"Di French team win, although dem look like African team. Actually, Africa win - di African immigrants wey come France. I hope Europe receive dat message...
No more racism inside Europe against di African pipo, no more discrimination against immigrants."
France beat Croatia 4-2. Dia team na im get players from different culture pass during di competition - 15 out of di 23 players for di national squad fit trace wia dem from come back to Africa, especially from kontris wey France bin rule before.
For twitter, just afta France beat Croatia on Sunday, one American author, Khaled Beydoun cause serious debate wen e call for "justice" for di team.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Beydoun tweet get more than 200, 000 retweet and more than 500,000 likes.
Some pipo criticize Beydoun say e dey bring politics enta sport while odas say di players na first and foremost French citizens even though dem get Africa root.
End of Di one wey oda users dey read well well











