World Cup 2018: How Africa migrants dey help European teams for Russia

The French team line up before a match with Uruguay

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di France team wey start against Uruguay for World Cup quarter-final get five players wey be sons of at least one immigrant parent: (Back row, L-R): Paul Pogba, Samuel Umtiti; (Front row) Corentin Tolisso; N'Golo Kante; Kylian Mbappe
    • Author, Fernando Duarte
    • Role, BBC World Service, Moscow

Three out of di four teams wey remain for Russia World Cup get sometin wey connect dem.

France, Belgium and England get many players wey be pikin of immigrant. make we see di numbers:

Sixteen out of di squad of 23 France players get at least one parent wey dem born outside di kontri. Two of dem na for French Caribbean islands dem born dem, wey no be realli France.

Eleven Belgium and six England players na di sons of at least one immigrant, and anoda four England players get roots wit Afro-Caribbean ancestry. One of dem, Raheem Sterling, na for Jamaica dem born am.

Mbappe and his father arrive at the stadium ahead of France v Uruguay

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mbappe papa, Wilfred, go from Cameroon to France

How France squad take get players from different kontris no suppose be surprise.

Di team wey win di 1998 World Cup -wey be di only one di kontry don win so far - dem celebrate dem say dem be true tori of di French society and nickname dem "The Rainbow Team".

France squad 2018 World Cup

Wia dis foto come from, Getty

Wetin we call dis foto, Sixteen out of di 23 players for di France squad na sons of immigrants

Belgium squad get 11 players wey be say at least one get immigrant parent, including players like Romelu Lukaku and Vincent Company, wey dia papa from Congo - Lukaku papa actually play for di national team of Zaire for 1990s.

Belgium football team lining up before a match against Brazil

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Of di Belgian team wey play quarter-final against Brazil, five players get at least one immigrant parent: (Back row, L-R) Romelu Lukaku (DR Congo); Axel Witsel (Martinique); Vincent Kompany (DR Congo); Marouane Fellaini (Morocco); Front row: Nacer Chadli (Morocco)

Pikin dem of immigrants also show face for di England team.

Gareth Southgate squad - wey get six players wey get at least one parent wey migrate enta UK, and Raheem Sterling wey dem born for Jamaica - dey sweet fans belle.

The England team lining up before a match with Sweden

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di England team wey play Sweden for di World Cup quarter-final get four sons of at least one immigrant parent: (Back row, L-R) Ashley Young (Jamaica); Dele Alli (Nigeria); (Front row) Harry Kane (Ireland); Raheem Sterling (Jamaica)