Cave rescue: Di divers wey comot di Thai boys from cave

Wia dis foto come from, AFP/Getty
Di pipo wey rescue di Thailand football team wey bin trap for cave na international divers wey collabo with Thai navy Seals.
Na British divers first see di 12 boys, but e be like di world join hand to comot dem from di cave.
Information no too plenti about those wey exactly dey involved because most of dem no wan tok.
Tori be say na many divers - Thai and foreign - join hand do am. Here na some of dem:
John Volanthen and Richard Stanton
Briton John Volanthen voice na di first di boys and dia coach hear afta nine days wey dem trap underground.
Im and fellow British diver Stanton na pipo wey Thai authorities first call, along with anoda British caving expert, Robert Harper.
Dem enta Thailand three days afta di football team miss.
Oga Volanthen na IT consultant, and oga Stanton, wey be former firefighter, na part of di South and Mid Wales Cave Rescue Team wey don do rescue operations, including for Norway, France and Mexico.
End of Di one wey oda users dey read well well
Richard Harris
Dr Harris, wey from Adelaide for Australia, get plenti diving experience. Na im first check di boys for di cave come give green light say make di rescue operation go ahead.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

If to say di boys bin too weak, to rescue dem by diving for dey too dangerous.
According to tori, Dr Harris don take part for cave diving for Australia, China, the Christmas Islands and New Zealand.
Thai Navy Seals

Wia dis foto come from, Facebook/Thai Navy Seals
Many Thai special forces na part of di rescue efforts. One na doctor - wey dem identify as Pak Loharnshoon - and three divers wey dem neva name wey choose to stay with di boys afta dem find dem underground one week ago.
Four Thai Navy Seals na dem be di last to leave di cave one Tuesday evening and na Rear Admiral Arpakorn Yuukongkaew lead dem.

Saman Gunan
Petty Officer Saman Gunan, wey dey 38 years, na retired Thai navy diver wey volunteer for di rescue efforts.
Im lose consciousness as im dey comot for Tham Luang cave, wia im deliver air tanks on 6 July.
Im dive partner try to revive am but im no fit and dem bring im bodi out of di cave.
Ben Reymenants
Belgian Ben Reymenants dey run dive shop for Phuket. Tori be say im dey group wey first find di boys on Monday.

Wia dis foto come from, facebook.com/ben.reymenants
Claus Rasmussen
Claus Rasmussen from Denmark and im don dey live for Thailand for years, wia im dey work with several different dive schools.
Im dey work as instructor for Ben Reymenants' company, Blue Label Diving.

Wia dis foto come from, facebook.com/mikko.paasi.3
Mikko Paasi
Finnish national Mikko Paasi na di founder of one diving centre for di small Thai island of Koh Tao, wia im specialise for technical diving.
Dat one mean say im dey focus on wreck and cave diving.

Wia dis foto come from, facebook.com/mikko.paasi.3
Ivan Karadzic
Ivan Karadzic, wey from Denmark, move to Koh Tao few years afta oga Paasi, and now di two of dem dey run di diving centre togeda.
Afta oga Gunan die for di final rescue efforts, oga Karadzic write for im Facebook wall: "Rest in peace. You be hero and we no go ever forget your sacrifice."
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Erik Brown
Dis man from Canada na technical diving instructor from Vancouver.
Im don dey dive tey-tey and follow set-up Team Blue Immersion, wey be technical diving school for Egypt.
On Tuesday night, im write for Facebook say im don do seven diving missions in nine days, wey amount to 63 hours inside di Tham Luang caves.

Wia dis foto come from, facebook.com/mikko.paasi.3













