UK Brexit palava: Boris Johnson don resign

Boris Johnson

Wia dis foto come from, AFP

Boris Johnson don resign im post as British Foreign Secretary.

Dis one na ontop serious gbege wey dey happun as UK dey try comot from European Union.

Na im be di second senior cabinet minister to resign for di same day.

On Sunday before midnight UK Brexit Sece bin resign too.

Prime Minister Theresa May don accept the resignation.

Now UK Health Secretary Jeremy Hunt don become new foreign secretary afta Boris Johnson resigne.

Culture Secretary Matt Hancock replace Oga Hunt as health secretary, as Theresa May sharp sharp appoint new members to fill space of pipo wey don waka comot her team.