You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Florida shooting: High school student do #NationalWalkoutDay
One month after one gun man shoot 17 students die for Marjory Stoneman Douglas High School Florida, USA, High school students don do protest waka comot for schools on top gun violence palava.
Di students dey do di protest waka to honour di 17 students wey die for 17 minutes on top #NationalWalkoutDay and #Enough and dem dey demand say make di American government take strong hand tackle gun mata for USA.
Many parents dey support dia pickins for di protest waka for social media say no be only for schools but dem want to dey safe for dia house, office and streets too.
Dem don plan three national action to take end gun violence palava for America.
14 March na for #NationalWalkoutDay, 24 March na for #MatchForOurLives and 20 April na NationalSchoolWalkout