You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Jennifer Aniston and Justine Theroux don separate
Hollywood husband and wife Jennifer Aniston and Justine Theroux dey go dia separate ways after two years of marriage.
Di two talk say na with love dem take reach decision for end of 2017 say, dem no marry again.
Dem no talk why o, but dem say dem wan remain very correct padi-padi after everybody waka go dia way.
Aniston, 49 and Theroux, 46, bin do secret wedding for August 2015 for Hollywood.
Two of dem join bodi do announcement say, "we na two best friends wey don decide say we no marry again."
Dem say dem for do am private, but sake of di "aproko people wey no sabi mind dia business" dem kukuma do announcement.
Dis na Aniston second marriage, she bin first marry Hollywood actor Brad Pitt for five years before dem divorce for 2005.