Ancient British 'Cheddar Man' people bin get black skin before-before

One new scientific tests show say British people wey live 10,000 years ago go don get black skin and blue eyes.
Researchers from Natural History Museum for London comot DNA from Cheddar Man, wey bi name of di complete skeleton wey old pass for Britain, wey dem find for 1903.
University College London research pipo come us di information to take build how di face go don look like.
Wetin e mean be say di light skin wey modern Europeans get no be like dat before.

Wia dis foto come from, Channel 4
Dis na di first time wey dem don do test on ancient British people. Because of dis, plenty things don come out about di first people wey settle for Britain after di last Ice Age.
Dem comot Cheddar Man skeleton from ground 115 years ago for inside Gough's Cave, for Sommerset, UK. Later, when dem look am well-well dem see say di man short pass modern human being and im height na about about 5ft 5in and e look like say im die for im early 20s.

E be like say light skin people enter Britain with some people from Middle East around 6,000 years ago. Cheddar Man go don mix well-well with dem.
Na later-later British people dark skin begin change to come look light.
End of Di one wey oda users dey read well well

Dem also say di test show say e be like Cheddar Man no sabi drink milk as adult, say na after Bronze Age e come begin sabi how to drink milk.










