You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Japan Princess Mako: Wedding date to ordinary man don change to 2020
Japan Princess Mako don postpone im marriage to her bobo until 2020.
Princess Mako, wey bi di senior elder daughter of Prince Akishino and Princess Kiko, postpone her wedding to Kei Komuro, after her grandpapa Emperor Akihito don comot di throne next year, di Japan public broadcaster NHK bin report on Tuesday.
Di princess been meet her fiancé Komuro, for university and last year dem announce say 2018 na di year dem go tie knot as husband and wife, even though e go mean say Princess Mako go lose all di enjoyment wey royals dey get.
Di couple say dem want more time to arrange dia ceremony and prepare for married life, NHK been quote di Imperial Household.
Mako wey bi one of only four royal grandchildren, must become ordinary person (commoner) after di wedding, according to laws of di royal family.