Trump no know if dem invite am come Prince Harry wedding

Wia dis foto come from, PA
US President Donald Trump say im no sure whether dem invite am come di Prince Harry and Meghan Markle wedding.
Na for di interview wey im do with Piers Morgan im talk dis one.

Wia dis foto come from, itv
Di wedding go happen for 19 May and when Mr Morgan ask am whether im don receive invitation, oga Trump talk say "I no know".

Wia dis foto come from, EPA
American actress Ms Markle no dey feel Mr Trump at all and na Hillary Clinton she support for di 2016 presidential election.
She don accuse Mr Trump before say im dey divide people and im no like women.
For di interview wey im give Mr Morgan, di American president say Prince Harry and Ms Markle look "like a lovely couple".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Na for St George's Chapel for Windsor Castle di wedding go happen.
Di Trump interview happen as im dey attend di World Economic Forum for Davos, Switzerland.
End of Di one wey oda users dey read well well











