Britain First video retweet: Donald Trump wan beg for di first time

Wia dis foto come from, Getty Images
US President Donald Trump say im ready to beg for di first time on top di anti-Muslim videos im retweet last year inside Britain.
Inside one television interview (with Piers Morgan) on ITV, Mr Trump say im know nothing about di group, Britain First, when im put dia messages for im tweeter page wey get forty-seven million followers.
Im say "I go surely beg if you go like me to do am."
Di tweets last November spoil relations with Britain, even prime minister, Theresa May yab di America leader. She say Mr Trump dey wrong to retweet di messages.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post







