Abu Dhabi don introduce new 'visa on arrival'

Di service also include di activation of di new 96-hour transit visa for travvelers for any country.

Wia dis foto come from, Wikki commons

Wetin we call dis foto, Di service also include new 96-hour transit visa

Passengers wey land for Abu Dhabi International Airport go fit get tourist visas within 15 to 30 minutes now.

Di Department of Culture and Tourism for Abu Dhabi, together with Abu Dhabi Airports, Etihad Airways and di Abu Dhabi General Directorate of Residence and Foreigners Affairs, don tier rubber new visa counter wey go make visa application process dey easy and quick for both transit and passengers wey just dey arrive for Abu Dhabi to get dia visa fast-fast.

Dis new service dey for Terminal 3 transit area inside Abu Dhabi International Airport (AUH).

Di service also include to give di new four-day, or 96-hour, transit visa to people from any country wey dey travel through Abu Dhabi International Airport.

Dis new visa counter wey dey tier rubber so, na part of di 'Life in Abu Dhabi' plan wey go make tourists get sweet experience and go also attract more visitors come di United Arab Emirates capital.

Before now, di transit visa dey available for only citizens wey come from certain countries while other passengers go apply though di official channels before dey land for Abu Dhabi.

Etihad Airways Executive Vice President (Commercial) -Mohammad Al Bulooki talk say "Di new transit visa na great plan for di emirate and for visitors

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Etihad Airways say di new transit visa na great plan for di Emirate and visitors