You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Drake don vex for fan wey dey touch girls
Plenty fans hail Drake say im do well after im shout for one fan say make im stop to dey touch girls.
Di rapper bin dey perform for one club for Sydney Australia when im stop, come point finger give one fan say "no dey touch girls again".
Im talk say im go comot stage go face di fan if im no comot hand from girls dem.
Na one person wey dey di show video di whole thing and e don dey trend well-well.
Many people for social media don hail wetin im do.