Iran: Earthquake don kill over 200

Wia dis foto come from, EPA
Strong earthquake don hit Sulaimaniyah province, di area wey dey between Iran and Iraq, sotay na at least 214 people don die, and more than 2,800 dey injured.
One Iranian aid agency say e go reach 70,000 people wey don need where to put head, stay, as di earthquake na one of di largest dis year.
Na Behnam Saeedi, wey be spokesman for Iran National Disaster Management Organization, talk for television say more than 850 dey injured.
State media for di two countries report say rescuers still dey search for people wey fit still dey trapped under buildings wey don collapse finish.
Officials say di shake-shake for ground reach magnitude 7.3, wey mean say e strong well-well, and people for Turkey and Israel feel am.
Di province where things tough pass na Kermanshah; dem don announce three days mourning.
Na so di earthquake destroy di main hospital of di town, wey be say dem dey struggle to give treatment to hundreds of people.
For di Iraqi side, na di town of Darbandikhan, wey dey di Kurdistan Region damage pass.
End of Di one wey oda users dey read well well
E pass 30 people wey injure for di town, according to Kurdish Health Minister Rekawt Hama Rasheed.
"Di situation there dey very critical," Rasheed tell Reuters.
Kurdish health officials add mouth say na at least four people die for Iraq, and at least 50 na im carry different injury.

Wia dis foto come from, Reuters
Di palava don cut electricity for many Iranian and Iraqi cities, and people wey dey fear more shake-shake don run outside enter street, even though di weather dey very cold dis time of di year.
"As na night e dey hard for helicopters to fly to di areas wey dey affected, and and some roads don cut troway...we dey worry about villages wey far," na wetin Iranian Interior Minister Abdolreza Rahmani Fazli talk for interview.
Sabi people say Iran dey get palava with earthquake from time to time. Na so one earthquake on December 26, destroy di city of Bam, kill about 31,000 people.










