Actress say 'Gossip Girl' star Ed Westwick rape am

Ed Westwick, English actor wey act for di series film Gossip Girl na di latest person wey dem say sexually assault woman.
Na one actress Kristina Cohen talk say di guy wey plenty people remember as Chuck Bass rape her.
She enter her Facebook to talk di tori and say na three years ago di thing happen wen she and one producer go visit Westwick for im house.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Cohen talk say Westwick bin first make her dey feel one kind as im dey talk about her but her producer friend no want make di actor feel one kind sef.
She talk as body dey tire her, she wan comot but Westwick come say make she sleep for im guest room.
Na im she go sleep but as she open eye, na im Westwick don climb her.
Di 28 year old Cohen wey don dey show for film since 2001 like Ladies Like Us, and Californication talk say fear catch her.
She talk say di producer wey she no call im name for her Facebook tell her say make she no talk about di matter at-all at-all.
End of Di one wey oda users dey read well well
But as she dey talk all dis one Westwick don talk im own inside im own Instagram.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post










