Kevin Spacey: Netflix go cancel House of Cards ontop sex wahala

Wia dis foto come from, Getty Images
Netflix don cancel House of Cards, one day after di lead actor, Kevin Spacey carry accusation say e sexually harass one small boy.
Di online pay-as-you-watch company talk say di allegation wey actor Anthony Rapp drop dey pain dem for chest.
For interview with online tori people Buzzfeed, Rapp talk say Spacey bin try tempt am for party for 1986. Na 14 years old di actor bin be dat time.
Spacey talk say e dey pass shocked to hear di tori but talk say im no remember wetin happen.
For House of Cards, Kevin Spacey dey act as wicked American politician Frank Underwood. Di drama don carry many praises and dem dey shoot di season six.

Wia dis foto come from, Getty Images
Kevin Spacey talk say he owe Anthony Rapp big apology for wetin e talk say fit be "big taboo behaviour wey happen because im drink".
Spacey also talk say im don dey live now as "a gay man" but people no like di time wey di Oscar winner choose to come out to talk dat one.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
People wey dey fight for di rights of gay, say to dey come out now wey sexual harassment matter don land for im head no dey good for di Lesbian Gay Bisexual Transgender (LGBT) community.
End of Di one wey oda users dey read well well
As Netflix dey talk say e go be dia last season, many reports say di producers don plan to end di series tey-tey, even before all dis wahala start.











