Xi Jinping: 'China time don come'

This file photo taken on 1 August 2017 shows China"s President Xi Jinping arriving at a ceremony to commemorate the 90th anniversary of the founding of the People"s Liberation Army, at the Great Hall of the People in Beijing.

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, Xi Jinping don dey control things for China since 2012 and tori people sure say dis congress go give am another five years as party leader

Di Communist Party for China don start di biggest political event wey dey happen every five years for di capital Beijing.

Di event na closed-door meeting and over 2,000 delegates dey attend. Na for dis summit dem go chose di people wey go lead them for another five years.

Closing ceremony of the Communist Party congress for 2012

Wia dis foto come from, MARK RALSTON/Getty Images

President Xi Jinping, wey also be di party chief, say time don come make di country enter "centre stage", which mean say na dem dey control things.

Im say di way China economy don dey grow steady show say other countries suppose to dey see say China be better choice for business.

Delegates prepare for the opening of the 19th National Congress of the Communist Party of China at the Great Hall of the People in Beijing, China 18 October 2017.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Delegates dey prepare for di opening of di 19th National Congress of di Communist Party of China for Beijing, China 18 October 2017.

Since Mr Xi enter office for 2012, di economy for China dey grow steady. But tori people say government don too dey put hand for everything and arrests of lawyers and activists don increase.

Chinese President Xi Jinping speaks during the opening of the 19th National Congress of the Communist Party of China at the Great Hall of the People in Beijing, China 18 October 2017.

Wia dis foto come from, Reuters

Im also introduce new rules wey go help increase discipline for di party and all di things wey im don do to fight corruption wey don punish over one million people.