You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
White nationalists don return to Charlottesville
White nationalist protesters don carry demself go back Charlottesville for United States, two months after fight for dia kill one woman.
Di mayor say e dey shameful say "di neo-Nazi cowards" don show face again for di statue of Confederate general Robert E. Lee.
Na far-right person, Richard Spencer organise di rally.
Im post video for internet and for inside di video, you go hear protesters dey shout "You no go replace us" and "We dey come back".
Di General Lee statue na di same place where dem do di "Unite di Right" rally for August, as people gather to protest say dem no want make dem remove di statue.
32-year-old woman, Heather Heyer, wey join other people to protest against di white nationalist, die for dia after one man drive car enter where people dey.