How Hurricane, Cyclone, Tornado and other natural disasters take different?

Dis na how Hurricane Irma look from space, as e begin near Puerto Rico

Wia dis foto come from, NASA/REUTERS

Wetin we call dis foto, Dis na how Hurricane Irma look from space, as e begin near Puerto Rico

Na just last week wey hurricane Harvey cause serious damage for Texas, now Irma don start im own.

Dis na hurricane season for countries wey dey di Atlantic region.

And you go don dey hear things like Storm, Tornado, Cyclone, Hurricane, Tsunami, etc etc.

So which one be which, and how dem take different?

  • Hurricane: type of storm wey get plenty-plenty rain plus strong wind. Sometimes sef thunder go follow join.
hurricane

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Hurricane wind
  • Tornado: air wey dey rotate with force from bottom of cloud come reach ground. Tornadoes dey very short and fit last reach one hour.
Tornado
Wetin we call dis foto, Tournado no dey too last
  • Tropical storm: dey form on top tropical oceans, and move with strong force and heavy rainfall.
Tropical storm

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tropical storm
  • Tropical cyclone fit be hurricane, typhoon, tropical storm or tropical depression depending on im location and strength.
  • Tsunami na when big wave on top water start because earthquake happen for under water.
Tsunami

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Tsunami
  • Avanlanche na rush of snow for hill or mountain. Avalanche fit happen for any slope, e get im season and e get some areas wey e di happen well well.
Avalanche

Wia dis foto come from, Tom Finnigan

Wetin we call dis foto, Avalanche for Peru
  • Mudslide na wen soil for area wey big, mix with water come begin flow very fast from one place to another.
People for street for Sierra Leone after di mudslide.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, People for street for Free Town after mudslide wey kill plenty people
  • Flash flood na dangerous kind of flood with heavy rain wey carry thunder. Things wey dey cause am na mudslide and when dam break.
Flash flood

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Flash floods dey happen
  • Monsoon na wind from Asia wey dey bring heavy rain and dry weather, depending on di time of di year wen e come.
Monsoon season dey on for South East Asia

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Monsoon season dey on for South East Asia
  • Storm na disturbance of atmosphere wey dey violent and e dey carry strong breeze, rain, thunder, lightning, or snow.