Houston Flood: 'Things don hard for us here'- Africans
After five days, Hurricane Harvey still dey scatter ground as im don cause two explosions at a chemical plant in Crosby, Texas, forty kilometres north of Houston.
Before di explosion happen, one police officer wey dey secure di site collapse after im smell chemical.
Di wahala with that plant begin when heavy rain make di plant no fit cool itself again.
Dis one dey happen even as di flood don move go anoda city wey bi Louisiana.
Texas get plenty African population, and many of dem dey affected by di flood.
Dozie na part of di people wey share him experience as di storm don affect Houston and now, Loiusiana. Im talk to BBC News Pidgin.
Hurricane Harvey don enter Louisiana
Di tropical storm don pack plenty water flood houses for Louisiana.
End of Di one wey oda users dey read well well
Louisiana dey share border with Texas wey Hurricane Harvey don already pass for Houston.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di rain wey don fall don dey pass all di rain wey don fall before.
Louisiana na di state with di tallest building for di US.












