Comedy Wildlife Photo Awards: Kangaroo wey do like e dey play guitar plus oda correct fotos dis year

Dem don announce finalists for dis year Comedy Wildlife Photography Awards. Dis na di selection of those dem pick from thousands of entries submitted from professional and amateur photographers from around di world, along with comment from di photographers. Di winners go dey announced on 23 November.

Australian Grey Kangaroo

Wia dis foto come from, Jason Moore/Comedy Wildlife Photography Awards

Jason Moore, dem take am for Perth, Australia

"I bin dey drive past one mob of western grey kangaroos wey dey feed for one open field filled wit attractive yellow flowers.

"I get my camera wit me, so I stop to grab some fotos. I suddenly notice say dis individual adopt funny pose - to me e be like say e dey practise im air guitar."

Tzahi Finkelstein, dem take am for Jezreel Valley, Israel

Swamp turtle with a dragonfly

Wia dis foto come from, T Finkelstein/Comedy Wildlife Photography Awards

"Di swamp turtle dey surprised, and smile at di dragonfly wey rest on im nose."

Allen Holmes, dem take am for RSPB Minsmere, UK

Avocet and Egyptian Goose

Wia dis foto come from, Allen Holmes/Comedy Wildlife Photography Awards

"I bin visit Suffolk for some days to try and track down some target species, but I decide to branch RSPB Minsmere reserve.

"Na hot day and I bin dey cool off for one of di bird hides.

"Wen I notice dis Egyptian goose wey fly to dis small island, I immediately focus on di bird, as I bin know say e go charge in and pursue di goose."

Paul Goldstein, dem take am for Masai Mara, Kenya

Leopard

Wia dis foto come from, Paul Goldstein/Comedy Wildlife Photography Awards

"I know say no be bird, and technically e no get di faculty of flight, but you no fit fault dis leopard effort to fly. Actually, three young cheetahs bin dey bother am and di pose indicate say she get hot temper."

Brigitte Alcalay Marcon, dem take am for di Kruger National Park, South Africa

Chacma baboon

Wia dis foto come from, Brigitte Alcalay Marcon/Comedy Wildlife Awards

"Dis young chacma baboon siddon for im mama back dey play di fool."

Adrian Slazok, dem take am for di east coast of England

Grey seal

Wia dis foto come from, Adrian Slazok/Comedy Wildlife Photography Awards

"For late autumn, seals dey comot for North Sea to give birth to dia pikin."

Christian Hargasser, dem take am for Masai Mara, Kenya

Lion cub on a branch

Wia dis foto come from, Christian Hargasser/Comedy Wildlife Photo Awards

"Na for evening wey get low light I take dis foto for Masai Mara."

Thomas Vijayan, dem take am for Katmai National Park and Preserve, Alaska, USA

Grizzly bears

Wia dis foto come from, Thomas Vijayan/Comedy Wildlife Photography Awards

"For Katmai National Park grizzly bears plenti and dis na why e be photographer paradise. However, di challenge na to take a unique frame."

Delphine Casimir, taken in Bali

A monkey relaxing

Wia dis foto come from, Delphine Casimir/Comedy Wildlife Photography Award

Dem take dis foto for monkey forest for Ubud, Bali. Dis na crazy place where monkeys na king."

Jacek Stankiewicz, dem take am for Bialowieza Forest, Poland

Greenfinches on a branch

Wia dis foto come from, Jacek Stankiewi/Comedy Wildlife Photography Awards

"I catch dis scene wen I dey watch birds for di Bialowieza Forest...From time to time di birds look like say dem dey get argument."

Lara Mathews, dem take am for Melbourne, Australia

Grey kangaroos

Wia dis foto come from, Lara Mathews/Comedy Wildlife Photography Awards

"Dem take am for Westerfolds Park, one beautiful and surprisingly wild pocket of land for di eastern suburbs of Melbourne, e dey famous for im kangaroo population. Di mob dey enjoy some morning sunshine wen dis joey decide to get silly and try im hand at boxing."

Jacques Poulard, dem take am for Spitsbergen, Norway

White grouse

Wia dis foto come from, Jacques Poulard/Comedy Wildlife Photography Awards

"Dem take dis foto for Spitsbergen during one very cold winter. Di white grouse dey come towards me and e look like a snowball wit eyes."

John Blumenkamp, dem take am for Grand Teton National Park, USA

Great grey owl

Wia dis foto come from, John Blumenkamp/Comedy Wildlife Photography Awards

"Dis great grey owl spend most of di afternoon posing majestically and looking, well, wise. But for a moment or two afta im do some elegant stretching, im give a look of 'shey Monday dey over yet?'."

Khurram Khan, dem take am for Barter Island, Alaska, USA

Polar bear

Wia dis foto come from, Khurram Khan/Comedy Wildlife Photography Awards

"Dis polar bear cub bin find dis wood pretty amusing and im dey play wit am wen im suddenly stop and stand up, and im use am almost like a performer dey do at times."

Zoe Ashdown, dem take am for Yorkshire, UK

Gannets

Wia dis foto come from, Zoe Ashdown/Comedy Wildlife Photography Awards

"For RSPB Bempton Cliffs, each year between March and October, about half a million seabirds use di chalk cliffs wey tower above di North Sea to nest and raise a family.

"Gannets dey mate for life and dem dey return to di same nest year afta year to raise dia young.

"I lie safely at di top of di cliff face, I dey able to observe di affection di gannets dey show each oda each time one return to di nest. Dem get greeting ritual, dem dey rub dia beaks and join dia necks togeda; na how dem dey strengthen dia bond. But na also brilliant opportunity to catch dem for various poses.

"I no realise I don take dis image until I reach house, but as soon as I see am I laugh out loud. Dem look like proud parents wey dey pose wit dia baby - definitely one for di family albums.

All photographs courtesy of Comedy Wildlife Photography Awards 2023.