Bola Tinubu: Wetin be Nigeria president role as Ecowas chairman

Wia dis foto come from, Twitter/@OfficialABAT
Nigeria president, Bola Tinubu on Sunday emerge di Chairman of Authority of the Heads of State and Government of the Economic Community of West African States (ECOWAS).
Dem announce Tinubu new role for di 63rd Ordinary Session of ECOWAS wey take place for Guinea Bissau.
Tinubu dey succeed President Umaro Embalo of Guinea Bissau as ECOWAS chair.
Di summit, wey hold on Sunday July 9, 2023, na di first international engagement of di president within di African continent since e assume office on May 29, 2023.
According to Dele Alake, wey be Special Adviser (Special Duties, Communications and Strategy) to President Tinubu, di 16 regional leaders dey expected to address matas on pressing sub-regional issues including report of di 50th Ordinary Session of di Mediation and Security Council (MSC) wey cover security challenges wey member kontries dey face, report of di 90th Ordinary Session of ECOWAS Council of Ministers on di financial situation of di body and di implementation of di African Continental Free Trade Area (AfCFTA).
Oda matas wey dem discuss na di report on di status of transition for di Republics of Mali, Burkina Faso and Guinea, di ECOWAS Single Currency Programme mata and di Report on Obstacles to Free Movement of Goods for di Abidjan-Lagos corridor.
Wetin go be di role of President Tinubu for Ecowas?
Sake of di office wey im currently occupy for Ecowas, President Tinubu go ensure say conflict for West Africa dey resolved.
End of Di one wey oda users dey read well well
Apart from conflict resolution, e go also play di function of liaising wit di president of government of Ecowas Commission.
E go also liaise wit di pipo wey dey responsible for di daily management and implementation of Ecowas policies.
As Ecowas chairman, President Tinubu gatz ensure say democracy dey promoted for West Africa.
Part of im role na to ensure say member states pursue economic integration of West African sub-region.
Already, President Tinubu don get down business as soon as im don declare say West African sub-region no go allow coup anymore.
"Democracy dey very tough to manage, but na di best form of goment and we all ascribe to am.," Tinubu tok.
Former Nigerian leaders wey don head Ecowas before
During im time as Nigerian Head of State, Olusegun Obasanjo bin lead di Ecowas from 1978 to 1979.
Also as Head of State, Muhammadu Buhari lead di Ecowas from 1985 to 27 August, 1985.
For 27 August 1985, Head of State Ibrahim Babangida lead di Ecowas till 1989.
Head of State Sani Abacha lead am from 7 July 1996 to 8 June 1998.
Head of State Abdulsalami Abubakar also lead di Ecowas from 9 June 1998 to 1999.
President Umaru Musa Yar'Adua lead di Ecowas from 19 December 2008 to 18 February 2010.
President Goodluck Jonathan lead am on 18 February 2010 to 17 February 2012.
President Muhammadu Buhari lead di Ecowas on 31 July 2018 to 31 July 2019.












