You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Presidential election tribunal updates: APC close case without calling any witness as Senate leader testify for president Tinubu
- Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin, Abuja
Nigeria President Bola Tinubu, Vice President Kashim Shettima and di All Progressives Congress (APC) close all dia defence on Wednesday.
Dem close dia defence wey dey challenge dia victory for di 25 February, 2023 presidential election.
While oga Tinubu and im vice call one witness, di ruling party no call any witness.
Peter Obi of Labour Party and Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party bin drag dem go court sake of alleged mago-mago for di presidential election.
How court waka on Wednesday
Nigeria President and im Vice through dia counsel Wole Olanipekun SAN announce say dem dey close dia defence against di petitioners afta dem call only one witness.
Di witness na Senator Opeyemi Bamidele, di Senate Majority leader.
For im oral testimony oga Bamidele tell court say Obi name no dey inside di membership list of Labour Party wey dem submit to Inec.
Im also tell court say di 25 February presidential election results for APC for Kano state wey dem record dey short of 10,292 votes against Tinubu.
End of Di one wey oda users dey read well well
During cross-examination by lead counsel to Peter Obi and Labour Party, Livy Uzoukwu SAN ask di witness if im dey aware of di European Union report about di election.
Di witness agree say di report dey - dem tender am as evidence.
On weda di letter from di United States Embassy to di Nigeria Police, dated 4 February 2003 address issues of alleged criminal allegation against President Tinubu, di witness say di Nigeria Police letter to di US request for search for general criminal records against President Tinubu.
Im add say di US letter wey clear Tinubu of criminal conviction na appropriate response.
Counsel to di APC Lateef Fagbemi wey no call any witness to defend dia victory, tell court say im dey close dia case.
Fagbemi SAN also tell court say im dey satisfied wit di evidence wey Tinubu and Shettima witness give in defence of di 2023 Presidential election.
Chairman of di five-man panel Justice Haruna Tsamani give di respondents ten days to file dia written addresses.
Im also give petitioners seven days to file dia written addresses as di law tok.
Dem give di respondents five days to reply.
Inec begin dia defence on Monday and counsel to Inec, Abubakar Mahmood tell di panel of Judges say dem go bring three witnesses one for each day.
Im also inform di court say di witness wey suppose come on Monday get emergency family problem.
Im beg court to adjourn am till on Tuesday 4 July 2023.
"My Lords we get three witnesses but di one wey suppose come today just call. me say im get emergency domestic issues so im no go fit come.
All di oda respondents agree to di plea and court adjourn di hearing to continue on Tuesday.
More pictures from court