World Cup 2022: Benzema, Reece James, Pogba, Haaland dey list of players wey miss out of Qatar 2022 World Cup

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Victor Ezeama
- Role, Broadcast Journalist
- Read am in 4 mins
Di Qatar 2022 Fifa World cup don start and kontris don get anoda chance to compete for di mundial.
Di World Cup na platform to showcase di best footballers on di planet.
Di tournament dey attract ogbonge attention. Na im make many kontris dey suspend dia leagues make players fit participate.
For di Qatar 2022 World Cup many top players miss am - some na sake of injury while for odas na becos dia kontris no qualify.
Most of di players wey dey miss out na sake of injury wey dem suffer while playing for dia clubs.
Top players missing from di World cup
While some players dey undergo rehabilitation to meet up wit di World cup, odas dey completely rule-out of di competition.
For some kontris, na dia key players wey dey make football fans reason how di competition go be for dem.
Di top players na:
End of Di one wey oda users dey read well well
Timo Werner: RB Leipzig forward Timo Werner no go follow for Germany 2022 FIFA World Cup campaign sake of injury.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di club confam di injury afta Werner get injury during di first half of Leipzig 4-0 win over Shakhtar Donetsk for UEFA Champions League on 2 November.
Tests show say di striker suffer syndesmosis ligament for im left ankle wey go keep am away until January.
Reece James: England defender Reece James go miss out on di World Cup. Di prolific right back suffer injury wen im dey on duty for im club, Chelsea for October.
James wey get 15 caps been dey recover afta e begin jog but Chelsea later say di defender go dey away for up to eight weeks.
Ben Chilwell: Chelsea left back go miss di 2022 World Cup afta e suffer during di club win over Dinamo Zagreb.
Chilwell suffer hamstring problem towards di end of di match.
"Following di injury sustained in our recent game against Dinamo Zagreb, Ben don undergo a scan on im hamstring.
"Results show say Ben don suffer a significant injury and di defender dey unfortunately expected to miss di World Cup," Chelsea tok for statement.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Paul Pogba: France midfielder Paul Pogba go miss di World Cup for Qatar afta failing to recover from knee surgery.
Pogba do operation for September, but im agent say afta a medical review, di midfielder no go fit return to playing for im club. Di agent also say di midfielder no go also fit make am to di World Cup.
"Following di medical review for Torino and Pittsburgh, e dey extremely painful to inform say Paul Pogba still need recovery time from im surgery," agent Rafaela Pimenta tok.
N'Golo Kante: France and Chelsea midfielder N'Golo Kante dey ruled out of di World Cup in Qatar afta im operation on hamstring injury.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di 31 year old suffer di injury during Chelsea 2-2 home draw wit Tottenham on 14 August.
Diogo Jota: Liverpool forward Diogo Jota go miss di World Cup due to a serious calf injury.
Na stretcher dem use carry di Portugal international comot during Liverpool game against Manchester City for Anfield.
"No be good news on Diogo. E go miss di World Cup," im manager, Jurgen Klopp tok. E go dey away until January.
Karim Benzema: Di Real Madrid Forward dey miss wetin fit be im last World Cup tournament. E suffer thigh injury in training.
Dis na dis first since 1978 wey pesin wey win di world player of di year award go miss di world - di last time e happun na 1978.
Karim Benzema say im dey disappointed say im no go dey France squad to di 2022 FIFA World Cup in Qatar.
"In my life no dey give up but tonight I ned to tink about di team, as I always do, so reason tell me to leave my place to pesin wey fit help us for World Cup," Benzema tok for Instagram post.
Sadio Mane: Senegal forward Sadio Mane go miss di World Cup due to leg injury e sustain wen e dey play for Bayern Munich.
Di 30-year-old pick up injury to im right fibula during Bayern 6-1 Bundesliga win over Werder Bremen.
Despite di injury, dem name Mane for Senegal 26-man squad for di World Cup but di former Liverpool forward no go feature for Qatar as e no fit recover from di injury.
Christopher Nkunku: Di Leipzig star pick up knock during training for France before dia trip to Qatar.
Di 25-year-old sustain di injury during Les Bleus' final training session for Clairefontaine.
Nkunku collide wit midfielder Eduardo Camavinga during dia final training - e limp comot for di pitch.
Players wey dia kontris no qualify for di World cup na; Erling Haaland (Norway), Mohammed Salah (Egypt), Gianluigi Donnarumma (Italy), Luis Diaz (Colombia), Zlatan Ibrahimovich (Sweden), Pierre-Emerick Aubameyang (Gabon), Riyad Mahrez (Algeria, Victor Osimhen (Nigeria)











