Davido son death: Tributes pour in over death of Davido and Chioma son

Wia dis foto come from, Davido/Chef Chi
Nigerian politicians don join dia kontri pipo enta social media to tok sorry give Davido and Chioma afta dem loose dia pikin Ifeanyi for Monday evening, 31 October.
Reports say Ifeanyi drown for swimming pool wey dey im papa house for Banana Island part of Lagos state.
Di parents of di boy never comot to comment on di incident. Ifeanyi be di son wey Davido get wit im partner, Chioma Rowland.
Presidential candidates for di 2023 elections Peter Obi, Bola Ahmed Tinubu and Atiku Abubakar send dia deep condolence to Davido, Chioma and di Adeleke family.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Oda Nigeria politicians include PDP deputy presidential candidate Ifeanyi Okowa, Shehu Sani, Abike Dabiri-Erewa and Oby Ezekwesili.

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, Twitter
Benjamin Hundeyin, di toktok pesin for di Lagos police command say dem don already invite eight workers for investigation of di mata.
E also say as of part di investigate, dem dey review di CCTV wey dey di house.
Ifeanyi, wey be Davido third pikin die days afta di family celebrate im third birthday for 20 October.
Nigerian actress Mercy Aigbe post say she dey ''completely heart broken! May God Console Ifeanyi parents, David and Chioma.''
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Singer Waje post say ''we dey keep you in our thoughts and prayers.''
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2
More Nigerians condole wit di pop star and im fiance

Wia dis foto come from, Screenshot
Popular comedian AY bin write one long epistle for im Instagram handle
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 3
British rapper and former girlfriend of Grammy Award winner singer, Burna Boy also sympathise with di parent.

Wia dis foto come from, Sceenshot

Wia dis foto come from, Screenshot
Wetin to know about Davido

Wia dis foto come from, Davido
Nigerian musician, Davido don make many music since im start im career for 2010.
Born on 21 November, 1992 di Nigerian-American singer na heavyweight for Nigerian music industry.
Forbes for 2020 label Davido as Afrobeats superstar. Dem say e be one of Africa biggest musicians.
Since im rise to fame, Davido don win multiple awards, including BET awards and MTV awards. He also dey signed on many endorsement.
For 2008, he make di Forbes Africa 30 Under 30 list.
Davido get 9.7 million followers on Twitter.
Wetin to know about Chioma

Wia dis foto come from, Chef Chi
Chioma Avril Rowland, wey pipo know and dey call Chef Chioma become popular afta she enta relationship wit Davido.
Davido bin introduce Chioma give di world for September 2019.
Although gist about dia relationship bin don dey for di beginning of di year with visit to one family event.
Dat time, for usual Davido fashion, oga cari Porshe give am as gift as she turn 23 years old wey scata Nigerians mind like wetin.
Na di same day, e give Chioma Porshe na im e drop new music wey im call Assurance wey feature madam for di video.
Di vibes wey bin dey flow for dat period show for di release of di song, wey make di video get ova one million view in one day.
Chioma and Davido enjoy close relationship pass im oda baby mamas.
Chioma be chef and she also dey for fashion business.