D'banj family members neva ready to tok as dem sad wella

Gate
Wetin we call dis foto, Di road wey lead to di star family house and na family members dey

Di family of D'banj dey feel sad on top di mata of im pikin wey die.

One family member tok say dem bin no want make di tori comot at all, at all.

Di family tok say no be happy tori so dem no wan tok about am and dem no start to enta dia.

When BBC tori pipo enta D'banj family house, im neva land di area and no sign dey of Lineo Didi, di mama of di pikin.

D'banj family house
Wetin we call dis foto, Dem tok say dem bin no want make di tori comot

As pesin dey enta di family home of Nigerian music star, D'banj, you go hear how di place quiet be like graveyard.

Di outlook for inside di house e no be like how di environment for social media dey burn with di tori of di death of di star pikin.

Daniel Oyebanjo III bin dey one year old wen im drown for inside swimming pool on Sunday.