You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nnamdi Kanu: Appeal Court go decide di Ipob leader 'Stay of Execution' mata later
Di Appeal Court for Abuja don hear di 'Stay of Execution' mata wey Nigerian goment file against Nnamdi Kanu, so dat dem no go release am until Supreme Court hear dia appeal.
Afta di three man panel of judges, wey Justice Haruna Simon Tsamani lead hear di case, dem tok say dem need time to study di mata and dem go tok di date of di judgement or tell tori pipo di judgement later.
Meanwhile for di hearing, Federal Goment Lawyer David Kasuwe bin tell di court say "to release Nnamdi Kanu na security risk to di pipo for South East and Nigeria in general"
E explain say Nnamdi Kanu na" flight risk pesin and make dem no release am becos if dem release am, e go hard to get am back to court."
But Nnamdi Kanu Lawyer Mike Ozekhome tell di Judges say wetin David Kasuwe tok no korect becos on di day wey court discharge Nnmadi Kanu, pipo for South East bin dey happy and celebrate.
"Di Stay of execution na to overrule di judgement of di court. Di release of Nnamdi Kanu go bring peace to di South East." Ozekhome tok.
E tell di court say Nnamdi Kanu no jump bail before and e no get any case to ansa sake of say court don discharge am as e beg di judges to consider di health situation of Nnamdi Kanu.
Federal goment bin drag Nnamdi Kanu, di Indigenous People of Biafra (Ipob) leader to Supreme court sake of say di judgement wey Appeal Court give on 13 October 2022 for Abuja no sweet dia belle.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di goment ask di Supreme Court to pack di judgement keep one side and restore di first charges against Nnamdi Kanu so dem go fit try am for trial court.
For notice of im appeal, di Public Prosecution of di Federation, Mohammed Abubakar, Assistant Chief State Counsel, D. Kaswe and A. Aluko and Senior State Counsel, G. Nweze, for di Department of Public Prosecution, Federal Ministry of Justice give six reasons for reasons for dia appeal.
For di Appeal Court Judgement on 13 October, 2022, di three Appeal Court Judges bin discharge Nnmadi Kanu as dem strike out all di charges wey goment sama di IPOB leader.
Dem also agree say ' e dey prohibited' to detain Nnamdi Kanu as dem order im release.
Dem also so di way goment take bring am back to di kontri break all international extradition process and even di Federal High Court no get power to hear di case in di first place.
Nnamdi Kanu still dey detention weeks afta di Appeal Court judgement.
Di Appeal Court judgement wey discharge Kanu
Di Appeal Court for Abuja on 13 October, 2022 discharge di charges wey Nigeria goment bring against Nnamdi Kanu.
Di three man panel wey Justice Jummai Hanatu lead chook eye for di case wey FG bring against Kanu say e no get case to ansa again as di Federal High Court no get jurisdiction to try am in di first place.
Court rule say Kanu arrest and forceful transfer to Nigeria dey illegal becos dem no follow extradition process.
Dem say dem bring am into Nigeria illegally.
Court further tok say federal goment fail to tok di location wia dem arrest Kanu despite di big allegations dem sama for im head.
Court add say as dem keep quiet, mean say dem agree wit wetin Kanu tok say dem kidnap am and bring am forcefully back to Nigeria.
Court further hold say e dey against law to detain and try Kanu for any court since dem bring am back illegally.
Justice Jummai for her judgement tok say dem no go make di mistake wey di lower court make, "even though dem get warrant of arrest, even though goment tell dem to arrest am, as far as no be inside di shores of Nigeria wia e commit di alleged offence, di arrest and forceful return to Nigeria dey illegal."
She explain say to even cari am go court immediately no dey proper sake of say di appellant get right to notification so dat im go get time prepare imsef on how to defend imsef for court.
Di lower court also make mistake as dem no address all di issues and answer all di questions raised by di appellant." Di judge bin rule.
Nnamdi Kanu case timeline
See more fotos from di hearing today: