Nasarawa lecturer viral video: Police arrest Federal University of Lafia lecturer and im daughter wey video show dey beat and naked one young girl

Read am in 2 mins

Nigeria Police Nasarawa State Command don arrest one University of Lafia Associate lecturer and im daughter for di beating and physical assault of one young girl.

Di state police tok-tok pesin tell BBC say dem arrest Dr Fred Ekpa Ayokhai wey be lecturer wit di Federal University Lafia, for di Department of History and International Studies, and im 18 year old daughter Emmanuella Ekpa Ayokhai wey be student of di same University, on top accuse say dem gada beat one Blessing wey also be student of di University.

DSP Ramhan Nansel tok say di lecturer son, Praise wey also be suspect and odas wey get hand for di beating, still dey at large.

E add say investigation still dey go on and wetin dem don gada so far na say dem beat di young girl because of disagreement between di two friends on top man fone number.

Wetin happun for di video

For inside one video wey don go viral, show as some group of persons dey assault di young lady. Dem beat and strip her naked, cut her clothes wit scissors and drive her go di middle of bush.

Di incident escalate from one disagreement between di young lady and her friend on top why one man phone number dey her fone.

Inside one video, wey one Twitter user @Sanchezbig17 post wey don go viral, Blessing abusers dey beat her wit big sticks.

Dr Fred Ekpa Ayokhai wey follow for di group of assaulters carry big stick dey hit di girl.

Inside oda videos di lecturer of History and International Studies for Federal Univeristy Lafia, use scissors cut her blouse, strip her naked and insult her.

Dem later drive her go bush wia dem continue di beating.

Police for inside statement bin say dem don arrest two suspects in connection wit di case and recover di motor dem take carry di victim go di undisclosed location wia dem assault her.