In pictures: Queen sporting memories

BBC Sport share photos of di Queen life in sport.

The Queen on a horse

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Queen get her first horse, one Shetland pony wey im name na Peggy, at di age of four and she begin to ride by di age of six. By her teens she don become ogbonge horsewoman, for dis picture here, she ride for di first time as monarch for di Trooping the Colour for 1952.
The Queen and Princess Margaret

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Queen love horses and she bin dey regularly attend race meetings. Hia she attend di 1950 Derby for Epsom wit her younger sister Princess Margaret
The Queen and Althea Gibson

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For 1957, Queen present di Wimbledon singles title to Althea Gibson, di first black-American to win di SW19 title
The Queen presents the FA Cup to Nottingham Forest captain Jack Burkitt in 1959

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Two years later di Queen attend di FA Cup final as Nottingham Forest beat Luton 2-1 for Wembley , and she present di trophy to di victorious captain Jack Burkitt
The Queen presents the 1966 World Cup to Bobby Moore
Wetin we call dis foto, Di Queen finest moment for Wembley na for 1966 wen she present Bobby Moore wit di Jules Rimet Trophy afta England 4-2 World Cup final win ova West Germany
The Queen and Virginia Wade

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, 1977 na anoda special year for di Queen. She celebrate her Silver Jubilee and bin attend di Ladies Singles final day as Virginia Wade win di title for Wimbledon
The Queen and Jurgen Klinsmann

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Queen attend di Euro 96 final for Wembley between Germany and Czech Republic. Jurgen Klinsmann, captain Germany, wey become champions
The Queen with David Beckham and Kirsty Howard

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, David Beckham and fundraiser Kirsty Howard present di Queen wit di Jubilee Baton for di opening ceremony of di 2002 Commonwealth Games for Manchester
The Queen drops an ice hockey puck before a match between the Guildford Flames and Aquacity Poprad in Slovakia

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For her tour of Slovenia for 2008, Dem invite di Queen for di ceremonial puck drop for one ice hockey match between Guildford Flames and Aquacity Poprad
The Queen at the 2012 Olympics

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Queen bin play a key role for di 2012 Olympic opening ceremony, she act for one short film with James Bond (Daniel Craig) before she appear to skydive inside di stadium. Before she then formally open di Games
The Queen with Tanni Grey-Thompson

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Queen also officially open 2012 Paralympics and met 11-time Paralympic champion Baroness Tanni Grey-Thompson
The Queen with jockey Ryan Moore

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Wen Estimate, wit jockey Ryan Moore, win di Gold Cup for Royal Ascot for 2013, dat na di first time wey a reigning monarch own di winner in 207 years
The Queen pats 2013 Gold Cup winner Estimate

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Estimate na one of di Queen most successful horses for di later years of her life
The Queen with Bryan Habana and Henry Speight before the 2015 Rugby World Cup

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Queen meet South Africa Bryan Habana and Australia Henry Speight for one reception before di 2015 Rugby World Cup
The Queen and Ryan Moore

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Top jockey Ryan Moore tok wit Queen afta im mount Twilight Son win di Diamond Jubilee Stakes for Royal Ascot for 2016
The Queen and double Olympic champion Nicola Adams

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Buckingham Palace na di venue for one reception wia di Queen bin host di 2016 for medallists for Rio Olympics and Paralympics, including boxing champion Nicola Adams
The Queen at 2017 Royal Ascot

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For 2017, di Queen once again attend di Royal Ascot and she bin dey part of di traditional daily carriage parade
The Queen continued to attend Royal Ascot and was back to enjoy the action at the Berkshire course during June 2021

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Queen continue to attend Royal Ascot and for June 2021 she return back to enjoy di action for Berkshire course
In October, the Queen started a global relay of the Commonwealth Games baton ahead of the event in Birmingham in 2022. She passed it to Paralympic gold medallist Kadeena Cox who carried it on the first leg of its journey.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For October 2021, di Queen start one global relay of di Commonwealth Games baton ahead of di event for Birmingham dis summer. She pass di baton to di Paralympic gold medallist Kadeena Cox wey carry out di first leg of di journey