You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
IEBC Kenya election 2022 results: Odinga and Ruto dey tight race as Kenyans wait to see who go be dia fifth president
Kenyans go to di polls on Tuesday, 9, August, 2022 to elect a new president and members of di national assembly, senators and county govnors wey go run di kontri for di next five years and dem go dey wait for di result afta polls officially close.
Kenya electoral commission on Monday declare Deputy President Williams Ruto as di new elected president wey go lead di east African kontri for di next five years.
Inside di final results wey di kontri wey Independent Electoral and Boundaries Commission (IEBC) chair, Wafula Chebukati announce, Ruto beat im main opponent Odinga wit 50.49 % of votes.
Ruto win more dan half of di votes wey dem cast across di kontri.
Four of di seven members of di electoral commission bin refuse to endorse di announcement, saying di results dey "opaque".
"We no fit take ownership ofdi result wey dem go announce sake o di opaque nature of dis last phase of di general election," tok Juliana Cherera, di vice-chairperson of Independent Electoral and Boundaries Commission (IEBC).
How dem call di winner?
To win di presidential race for di first round, a candidate need:
- more dan half of all di votes wey dey cast across di kontri
- at least 25% of di votes cast in a minimum of 24 counties.
Voters go also dey choose MPs and senators to go di national parliament, county govnors and county assembly members, as well as 47 women representatives to sit for di National Assembly.
End of Di one wey oda users dey read well well
Counting go start for di polling stations shortly afta voting ends. Officials go take a photo of di final tally and send di image to both di constituency and national tallying centres.
To ensure transparency, di media, political parties and civil society groups dey encouraged to run dia own tallies using final results wey dem go declare at di more dan 40,000 polling stations.
But only di electoral commission fit declare di winner of di presidential election afta e verify di physical and digital forms wey dey sent in to di national tallying centre.
Afta di declaration of di winner, dem go swear in di president-elect on di 14th day afta di date of di declaration of results of di presidential election.
And dat na if di results no dey challenged for di Supreme Court or if no runoff dey.
BBC use publicly available data wey we dem get from di official website of di Independent Electoral and Boundaries Commission (IEBC) to tally di provisional results of di presidential election.
As di commission dey carry out di verification process, delay fit dey for di way di BBC dey update di data. Under Kenya electoral law, di IEBC go announce di final results of di presidential election.
Check di results hia
Move around here to see how dem vote county by county
Who dey di race to run Kenya?
Governor results 2022 Kenya: Na here you go see Gubernatorial election results for Kenya
Continue to dey refresh dis page to see di results as we dey get dem.