Man Utd v Brighton highlights: How di Red Devils lose 2-1 to Seagulls for Old Trafford

Brighton and Manchester United players

Wia dis foto come from, Getty Images

Brighton beat Manchester United 2-1 for dia first match for di premier league dis season for Old Trafford.

Di game na di first competitive fixture of Man Utd new coach Erik ten Hag tenure.

Christian Eriksen and Lisandro Martinez bin make dia Premier League debut for Manchester United, while Cristiano Ronaldo wey dey bench bin come up for second half.

Anthony Martial bin dey out with a hamstring strain, but Jadon Sancho and Luke Shaw bin dey on afta dem recover from illness.

Brighton midfielder Alexis Mac Allister bin dey available for di game meanwhile, Chelsea loanee Levi Colwill dey for bench for di trip to Old Trafford.

Live updates as di match happun

FIRST HALF

Game don start.

Man Utd 0-0 Brighton

9 mins: Good start for the home team wit dia attacking play.

15 mins: CLOSE! Brighton bin enta United penalty area and na former United striker Welbeck - wEey create di chance for di right hand side.

But unfortunately for am, im slip na United clear di ball.

17 mins: More pressure from Brighton around di United area - although e no too bother De Gea .

Gross bin attempt to pick out March for di right hand area, but di ball just too long.

20 mins: Anoda almost moment for Brighton. Caicedo cross towards di back post, Welbeck jump to meet di ball.

But im come only direct im header wey no trouble United.

30 mins: GOAL!

Man Utd 0-1 Brighton

Di visitors don score (Na Gross score di goal)

Marcus Rashford (left) and Pascal Gross (right)

Wia dis foto come from, Getty Images

34 mins: Man Utd fans no go like to see dis one, for Premier League last season, Brighton no lose a game when dem score first. Dem draw three and win ten.

37: Man United neva really create chances for dis first half.

39 mins-GOAL!

Man Utd 0-2 Brighton

Di visitors score again (Gross score again, 39)

Brighton never win for Old Trafford before.

40 mins: Ronaldo dey warm up for Man Utd.

45 mins: Dem add two extra minutes.

45+2 mins: Half time

Man Utd 0-2 Brighton

SECOND HALF

Second half don start!

47 mins: Eviritin dey go Brighton way, free header for Welbeck but e go wide.

49: Close! Good cross inside di box from Eriksen!

Rashford bin dey di back post, but no fit reach di ball.

52 mins: Substitution for Man United

Ronaldo don come and na Fred comot.

60 mins: Big save from Brighton goalkeeper afta Ronaldo cross find Rashford but di keeper save di shot.

68 mins: GOAL!

Man Utd 1-2 Brighton

Na scrappy goal from Man United corner.

73 mins- Man United don begin put Brighton under pressure.

Eriksen passes dey cause trouble for di visitors.

76 mins: OVER di bar! Martinez shot just go ova di crossbar.

83: Mac Allister fire im shot wide.

85 mins: Di tempo of di match don drop wit few minutes to go.

90 mins: Three Man Utd subs now - Sancho, Shaw and Fernandes off, wit Elanga, Garnacho and Malacia in.

Malacia dey make im Premier League debut.

FULL TIME

Erik ten Hag lose im first Premier League match as Manchester United manager.

Man Utd line-up

Man Utd line-up

Man Utd XI: De Gea, Shaw, Martínez, Maguire, Dalot, Fred, McTominay, Fernandes, Eriksen, Sancho, Rashford.

Brighton line up

Brighton XI: Sanchez, Webster, Dunk, Veltman, Trossard, Caicedo, Lallana, March, Mac Allister, Gross, Welbeck

Brighton line-up