Lagos okada ban update: Commercial motorcycles go stop work for six LGAs from June 1 - See wetin to know

- Author, Andrew Gift
- Role, BBC Pidgin
Lagos state goment say dem go crush di commercial motorcycles A.K.A okada wey dem seize during di first day of enforcement of di total ban on okada for some parts of di state.
Goment ban on okada for six LGAs of di state come into effect on June 1. Goment Taskforce enforce di ban for Eti-Osa, Ikeja, Surulere, Lagos Mainland, Lagos Island and Apapa.
Di crushing of di bikes wey dem seize go happun on Friday for di state capital Ikeja.
Lagos police tok tok pesin Benjamin Hundeyin tell BBC Pidgin say dem seize about 140 okada on day one of di enforcement.
E say dem also seize one dispatch rider bike sake of say e carri passenger, say dat one na offense too.

Di total ban on commercial motorcycles popularly known as okada for six LGAs of Lagos state southwest Nigeria go start June 1 2022.
Di six local goment wey goment put di total ban na Eti-Osa, Apapa, Surulere, Lagos Mainland, Lagos Island and Ikeja di state capital.
Govnor Babajide Sanwo-Olu announce di ban few weeks ago and direct di state security teams to enforce di ban once e come into effect.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di govnor for meeting wit security teams say di total ban na first phase of dia plan to ban okada for di state.
Penalty for okada ban offenders
Wen we ask police wetin go be penalty for defaulters of di ban, dem say any bike wey dem seize, di owner go forfeit am completely.
For di riders and passengers wey dem arrest, police say dem go carri dem go mobile court, say na di mobile court go determine dia fate.
Our reporter monitor di enforcement process on day one and confam say total compliance dey for di routes wey im visit wey include Ojodu Berger for Ikeja LGA, CMS and Obalende for Lagos Island, Falomo for Eti-Osa LGA and Surulere.
Reports bin fly upandan say police and bike men bin clash for di Agege axis of di state, but police say no clash happun.
"If you want collect pipo something, dem go try show resistance" na so Mr Hundeyin tok.
Tori be say though Agege no follow for di six LGAs wey goment put total ban on, but e dey among di 600 routes wey goment put okada restrictions on during di first ban.

Why goment ban Okada
Over di years, some okada riders don involve in kasala with residents and motorists in Lagos.
Deme don accuse some Okada riders say dem dey rob pipo wit dia bikes, dem accuse some of rough riding on highways and say dem dey cause plenti accidents and deaths.
Dis na part of why goment bin put restrictions on Okada for di state for February 2020, but some still continue to dey bone di order and still dey ride for restricted areas until di latest ban.
Govnor Sanwo-Olu say di ban follow di masterplan of di state and go helep stop plenti cases of accident and crime related activities wey pipo dey use Okada do for di state.
Di latest ban come afta one incident happun for Lekki axis of di state wey lead to di killing and burning of one Mr David Umahi allegedly by okada men.
Police arrest at least seven pesins ontop di killing of di man wey be music engineer.

How Lagos wan enforce Okada ban
During di announcement of di total ban on Okada, di govnor direct di security teams to arrest any Okada wey dem find for di banned areas.
Lagos police tok-tok pesin for statement also tok say dem go begin arrest passengers wey Okada pipo carri as dem too get case to ansa unto why dem dey ontop Okada for banned route.
Since di announcement, police begin sting operations and capture 115 bikes for Lekki axis.
Dem also seize at least anoda 400 bikes during raids for oda locations.
Since goment announce di first ban, Okada men and security teams don clash plenti times especially wen police go to enforce di ban order.
Wetin be di alternative means of transportation to Okada?
Commissioner for Information Gbenga Omotosho say goment add additional mini buses and taxis for di banned routes to help sort out transportation gaps di ban on okada fit bring.
Di commissioner also say dem add more boats for di waterways.
Afta goment announce restrictions on wia okada fit ply for Lagos for February 2022, dem announce say dem dey introduce more BRT buses.
Dem also introduce mini buses wey go dey ply di routes wey goment remove bikes from.
Also, di private commercial buses wey pipo sabi as danfo and private minibuses also known as korope na also alternatives to okada.

Arewa community for Lagos reaction to okada ban
Within dis period, di joinbodi of pipo from di Arewa community for Lagos direct dia members to obey di state goment directive to ban okada for some areas in di state. Arewa pipo na pipo from di northern part of Nigeria.
Dia members dey spread across Nigeria. Plenti members of di members be okada riders for lagos and di ban dey affect dem.
Afta dia meeting on May 22, dem release nine points agreement say dem go support di goment order to ban okada and oda goment policy wey include how to improve security for di state.
“Di ban on okada no be new law for di state, e don dey exist since ten years, we don resolve say all our members go comply by di law, sake of say dem be law abiding citizens.” Na wetin dem write for statement.
Dem also condemn activities of pipo wey dem refer to as ‘foreigners’ wey dey come from oda kontris dey cause kasala and commit crime in di name of genuine bike riders.
Okada over di years bin dey make transportation easy for Lagos pipo especially sake of di heavy traffic jam wey di city dey witness daily.
But wit dis total ban for some areas, who know how di pipo go fit handle dia transportation mata.
Ahead of di 1st of June, police for Lagos enter street on May 31, to do ‘show of force parade’ to show how dem dey prepare to enforce di ban.
Police say dem dey ready to handle any protest wey fit threaten di peace of di nation.
Areas wey di old restrictions cover
Apapa LCDA
Apapa Iganmu LCDA
Surulere LCDA
Itire LCDA
Ikate LCDA
Coker-Aguda LCDA
Ikeja LCDA
Onigbongbo LCDA
Ojodu LCDA
Eti-Osa LCDA
Ikoyi Obalende LCDA
Iru LCDA
Victoria Island LCDA
Lagos Island LCDA












