Billboard Hot 100: Tems, Wizkid, CKay and oda Nigerian stars wey don top di popular music chart

Wia dis foto come from, Twitter/ @temsbaby
Nigerian music artiste, Tems don become di first Nigerian wey song wey get her voice debut for Number one for di Billboard Hot 100.
Di song na "Wait For U" wey feature both Drake and Tems.
Dis na from Future new album "I Never Liked You".
Although dis no go be di first time wey Nigerians dey make am to di top of di Billboard charts.`
Who be Tems?
Tems wey her real name be Temilade Openyi blow with her 2019 single, Try Me.
She sef don dey follow build fanbase for Nigeria and around Africa and di world.
Many pipo vibe to her hit song Crazy Ting wey dey her EP If Orange Was a Place wey she release in 2021.
She also feature for Wizkid and Drake songs wey give am more popularity for 2021.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Wizkid
Billboard bin name am Hip Hop Rookie of di month of October 2021.
Wizkid feature am for inside Essence and di song reach number one for Billboard Adult R&B Airplay Chart.
Di talented female artiste still dey cook more hit songs and her fans dey expect di bangers from her dis year 2022.
Na she dey number three position for Boomplay Nigeria top rising artistes of 2021.
Nigerian Artistes wey enta Billboard Hot 100
Wizkid

Wia dis foto come from, Getty Images
For 2016, Wizkid feature for Drake Song One Dance wey become di rapper first Billboard Hot 100 Number 1 song.
Although, unlike Tems collabo, e no start from number one, but e climb reach dia.
Im own song with Tems, Essence also enta Billboard Hot 100, although dat one peak for No 82. But e bin break records as di first Nigerian song to do dat kain tin.
CKay

Wia dis foto come from, Twitter/ @ckay_yo
CKay bin go global with di release of im 2019 hit single Love Nwantiti sotay e enta di Billboard Hot 100 peak for No 3.
Di song bin popular for 2020 sotay e lead to plenti remixes with international artistes and even a French version of di song.
Fireboy DML

Wia dis foto come from, Oluwaseye Olusa
YBNL golden pikin, also enta Billboard Hot 100 afta im collabo with Ed Sheeran for di remix of im hit song, Peru.
Di song spend 14 weeks running for di chart and peak for Number 53.
Burna Boy

Wia dis foto come from, Getty Images
Burna Boy enta di Billboard with di release of Justin Bieber latest album.
Di song wey di Odogwu feature inside Loved by you peak for No 87 for di charts.
Wetin be di Billboard Hot 100?
Billboard Hot 100 na weekly chart list to rank di most popular songs based on sales, digital streaming numbers and radio plays audience impression.
Na di Billboard Magazine dey collate am.
Dem bin start di Bill Bord Hot 100 for August, 1958 and till now, na still di standard to measure song popularity for di United States of America.











