APC Presidential primaries: Bola Tinubu, Yemi Osinbajo, Rotimi Amaechi, Yahaya Bello - Meet APC aspirants wey wan replace Muhammadu Buhari as President

Bello, Okorocha, Tinubu, Amaechi, Osinbajo, Umahi

Wia dis foto come from, Bello, Okorocha, Tinubu, Amaechi, Osinbajo, Umahi

    • Author, Fiona Equere
    • Role, BBC News Pidgin

Election season don start for Nigeria and di race for who go replace President Muhammadu Buhari for Aso rock don dey hot.

For im party - di ruling All Progressives Congress - about seven aspirant don declare dia interest to run for di highest office for di land.

Di kontri general election go happun for 2023, according to di Independent Electoral Commission.

Next year Presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023 according to di election office INEC.

While govnorship and state assembly elections go hold for March 11, 2023.

INEC don give all political parties for di kontri deadline of June 2022 to do dia primaries and produce dia candidates wey go fly di party flag for di general election.

Dis na guide to who dem be.

2px presentational grey line

Professor Yemi Osinbajo

Nigeria Vice President

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria Vice President

Yemi Osinbajo na Nigerian lawyer, professor, and politician wey be di 14th and current Vice President of Nigeria since 2015 under di All Progressives Congress (APC).

E serve as Attorney General of Lagos State from 1999 to 2007 and hold di title of Senior Advocate of Nigeria (SAN).

For 1999, Osinbajo gbab appointment as Attorney-General and Commissioner for Justice for di cabinet of Lagos State Govnor Bola Tinubu.

Afta e serve during both of Tinubu four-year terms, Osinbajo comot goment for 2007 and return to law. E follow dey do lecturing plus preaching for di Redeemed Christian Church of God.

Before di 2015 presidential election, dem chose Osinbajo as running mate to APC nominee Muhammadu Buhari.

Na dia ticket defeat di den-incumbent President Goodluck Jonathan and Vice President Namadi Sambo.

Four years later, im win re-election.

2px presentational grey line

Bola Tinubu

Former Govnor of Lagos

Wia dis foto come from, Google

Wetin we call dis foto, Former Govnor of Lagos

Bola Ahmed Tinubu alias Jagaban, na man of many parts and im don dey very active for Nigeria political life for many years now.

Di 69 years old get reputation as a political godfather wey dey use im power and influence to support im candidates.

Im na accountant wit degree from Chicago State University for United States, and im work for major companies including Mobil Oil Nigeria before im win senate seat for 1992.

E later go on exile during di rule of military goment sake of im bin dey involved wit di pro-democracy National Democratic Coalition.

Afta di death of military leader General Sani Abacha, im return for 1998 and immediately return to politics.

Bola Ahmed Tinubu na two term govnor of Lagos state from 1999 to 2007.

Although im bin no hold any political office afta 2007, but e get hand for di grooming of Lagos state govnors since den.

Jagaban describe imsef as "talent hunter" wey dey "put talents for office, I help dem," im tell tori pipo Reuters for 2015 during Lagos govnorship election.

2px presentational grey line

Rotimi Amaechi

Nigeria minister of Transport

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria minister of Transport

Rt. Hon. Chibuike Rotimi Amaechi na Nigeria Minister of Transportation and former Governor of Rivers State.

Dem born am for Ubima, Ikwerre Local Goment Area of Rivers State on 27th May, 1965 to late elder Fidelis Amaechi and wife Mrs. Mary Amaechi.

Amaechi start im educational for St. Theresa primary school from 1970 to 1976, where e pass im first school leaving certificate.

Afta dat e proceed to Government Secondary School Okolobiri for 1977, finish dia and get im West African School Certificate for 1982.

Amaechi later attend University of Port Harcourt for 1983, wia e graduate with honours degree in English Studies and Literature for 1987.

Na for University of Port Harcourt e lay di foundation of im political life.

Amaechi later become Rivers State Governor for 2007 to 2015 under PDP ticket. E also become Nigeria govnors forum chairman within dat period.

For 2015 Ameachi become di Director General of President Muhammadu Buhari Campaign Organization.

E occupy dis position again for 2019 afta Buhari bin appoint Transportation Minister wen e form him cabinet after 2015.

And him still hold dat position till date.

2px presentational grey line

Who be Dave Umahi

David Umahi:

Wia dis foto come from, David Umahi:

Wetin we call dis foto, Ebonyi state govnor

David Nweze Umahi, na two term govnor of Ebonyi state - e become govnor for 2015 under im former party, Peoples Democratic Party (PDP).

E later join di All Progressive Congress (APC) for 2020.

Dem born Umahi wey from Uburu for Ohaozara local goment area of Ebonyi State for for January 1964.

Umahi enta politics early and by 2007 e become di acting chairman of di Ebonyi State chapter of di PDP.

From 2009 to 2011 e serve as state chairman of di party.

Oga Umahi later serve for di governing board of di Federal Medical Centre for for one year.

2px presentational grey line

Yahaya Bello

Kogi state govnor

Wia dis foto come from, Kogi state Govement

Wetin we call dis foto, Kogi state govnor

Yahaya Bello na one of di youngest aspirant for di presidential race at 46 years old.

Na 18th June 1975 dem born am and e from Agasa, Okene Local Government Area of di state.

Bello na di be present govnor of Kogi state, for North Central region of Nigeria.

E attend Government Secondary School Suleja for Niger State wia e obtain im Senior School Certificate Examination for 1994.

From dia e attend Ahmadu Bello University Zaria to study Accounting wia e graduate for 1999. E go back to Ahmadu Bello University, Zaria to obtain a Master's degree in Business Administration in 2004.

Im be di fourth democratically elected govnor of Kogi State.

2px presentational grey line

Rochas Okorocha

Former Imo State Govnor Senator Rochas Okorocha

Wia dis foto come from, @REALROCHAS/TWITTER

Wetin we call dis foto, Former Imo State Govnor Senator Rochas Okorocha

Rochas Okorocha na past govnor of Imo state and current Senator wey dey representing Imo West Senatorial district for di 9th national assembly.

E serve as govnor from 2011 to 2019 first wit All Progressives Grand Alliance (APGA),before e decamp to di All Progressive Congress.

Na APC okorocha dey now.

Aside politics Okorocha na businessman wey get several investments for Nigeria like real estate.

E also be philanthropist wey get foundation wey e dey use help poor children.

At 59 years, Okorocha na one of di experience politicians for im party, because him don contest for di position of president before.

Na 22 September 1962 for Ogboko, Ideato South, for Imo State dem born am.

2px presentational grey line

Dr. Kayode Fayemi

Kayode Fayemi

Wia dis foto come from, Kayode Fayemi

Dr. Kayode Fayemi na former Minister of Mines and Steel Development and present Govnor of Ekiti state.

E serve as minister from 2015- 2018.

During im tenure as Minister, he also serve as Chairman of di governing board of Nigeria Extractive Industries Transparency Initiative.

Dr. Fayemi get degrees for History and International Relations from di University of Lagos and Obafemi Awolowo University respectively.

E also get Doctorate in War Studies from King's College, University of London and na Fellow of di Centre for Peace and Conflict Studies, University of Ibadan.

Fayemi na former coordinator of di Progressives Governors Forum and a two-time Chairman of di Nigeria Governors Forum. E say him entry into di race go rebirth a new Nigeria.

2px presentational grey line

Godswill Akpabio

Godswill Akpabio NDDC

Wia dis foto come from, Godswill Obot Akpabio

Wetin we call dis foto, Godswill Obot Akpabio

Dem born Godswill Obot Akpabio for 9 December 1962.

E complete im primary education for Methodist Primary School, Ukana, and from dia go Federal Government College, Port Harcourt, Rivers State for im O' and A' levels certificate.

Akpabio Study Law for University of Calabar and attend Nigeria Law School for Lagos.

E do work as teacher and for small time practice for Paul Usoro and Co. wey be law company.

And work for EMIS Telecoms Limited wia im become company Managing Director.

Akpabio journey inside politics begin for early 2000.

E serve as Commissioner for Petroleum and Natural Resources for Akwa Ibom state.

2007 e become Akwa Ibom State Govnor under Peoples Democratic Party (PDP) ticket. Enta for second time for 2011.

2013 e become chairman PDP Governors Forum.

2015 e win Senatorial seas of di Akwa Ibom North West Senatorial District (Ikot Ekpene).

2015 e become Senate Minority Leader.

August 2018 - Senator Akpabio resign as Senate Minority Leader and port to All Progressive Congress.

July 2019 - President Muhammadu Buhari nominate am for Minister for Niger Delta Affairs.

Senate confam am di following month for August 2019.

For 2019, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin investigate oga Akpabio ontop alleged N100 billion (N258 million) fraud during im 2007 to 2015 time as govnor, although di corruption police no file any criminal charge las las.

2px presentational grey line
Senator Ibukunle Amosun

Wia dis foto come from, Senator Ibukunle Amosun

Ibukunle Amosun na senator and former govnor of Ogun State for southwest Nigeria. Na January 25, 1958 dem born am.

E serve as Govnor for di Gateway state from 2011 to 2019.

Senator Amosun na qualified accountant wey attend University of Westminster for London, United Kingdom wia e acquire Master of Arts in International Finance.

Before e go school for UK e bin attend Ogun State Polytechnic, wia e graduate wit Higher National Diploma for 1983.

Amosun during im declaration speech for president tok wia e go focus on.

"Di two pillars of di agenda wey I go torchlight in di weeks ahead na national security and economic development," e tok.

"Ontop dis two pillars, we go create a national architecture for human flourishing wey neva happun before for our national history." Amosun add put

2px presentational grey line

Dr Tunde Bakare

Dr. Tunde Bakare

Wia dis foto come from, Dr. Tunde Bakare

Dr Tunde Bakare na pastor and founder of The Latter Rain Assembly church.

Na November 11, 1954 for Abeokuta, Ogun State dem born Pastor Bakare into Muslim Family.

Pastor Bakare say im journey into Christianity begin for September 24, 1974.

E start im ministry for May 1988 wia e pioneer di first Model parish of di Redeemed Christian Church of God.

Pastor Bakare na qualified lawyer, e do im call to bar for 1981.

Im practice law wit Gani Fawehinmi Chambers, Rotimi Williams & Co and Burke & Co, Solicitors.

Before him establish im own law firm Tunde Bakare & Co (El-Shaddai Chambers) for October 1984.

Pastor Bakare na minister wey like to torchlight national issues.

Im political journey start for 2011 wen im become running mate to Muhammadu Buhari for di now-defunct Congress for Progressive Change.

2px presentational grey line

Tein Jack-Rich

APC Presidential primaries: Bola Tinubu, Yemi Osinbajo, Rotimi Amaechi, Yahaya Bello - Meet APC aspirants wey wan replace Muhammadu Buhari as President

Wia dis foto come from, Tein Jack-Rich/Facebook

Wetin we call dis foto, Tein Jack-Rich na one of di youngest presidential aspirants for APC

Tein Jack-Rich na di founder of Belemaoil Producing Limited.

Jack-Rich wey hail from Rivers State announce on Friday, 13 May say im go run for president on di platform of di All Progressives Congress.

Dis na afta im submit im N100 million presidential forms to di party.

Di 47-year-old entrepreneur study Petroleum Production Technology for Panola College Cartage, United States.

Im also study Business Administration for di University of Wales, and Business Management for Usam University.

During im speech as im formally declare for president, Jack Rich tok say e go focus on youth and women empowerment, infrastructure and job creation if e enta as president.

2px presentational grey line

Ken Nnamani

Ken Nnamani

Wia dis foto come from, Ken Nnamani

Na former senate president wey come from Enugu state for eastern Nigerian.

Na 2005 e become president of di senate, position wey e occupy until 2007.

Asides politics Oga Nnamani get experience for business too, some of di companies wey im don lead na Export, Minerals and Finance Limited, DAEWOOE E & C to mention a few.

Di former senate president na graduate wey school abroad.

E attend Ohio University, Athens, USA wia e graduate wit Bachelor of Business Administration.

Also e get Master of Business Administration for dat same university too.

At 73 years, Oga Nnamani na one of di experienced south east aspirant wey dey di race.

2px presentational grey line

Ahmad Lawan

Ahmad Lawan

Wia dis foto come from, Ahmad Lawan

Senator Ahmad Ibrahim Lawan, na di current President of di ninth Senate.

E dey represent Yobe North Senatorial District for northern Nigerian.

Senator Lawan na one of di few northerner wey dey di race.

Di Senate president na man wey go school well-well.

E get Bachelor's Degree in Geography from University of Maiduguri.

Master's Degree In Remote Sensing from Ahmadu Bello University, Zaria.

And Doctorate Degree In Remote Sensing/GIS for Cranfield University, UK.

Dem born Senator Lawan for December 1, 1959.

2px presentational grey line

'Di president go play major role to determine who go pick di ticket'- Analysis

Sobeye El, lawyer and APC member.

Wit few weeks to di APC party convention more candidates don join di race to contest for president.

Ekiti state govnor Kayode Fayemi and former Govnor of Akwa Ibom state Godswill Akpabio na di new faces for di race.

As tins be so di fate of dis aspirants dey in di hands of di 2,260 APC delegates wey go vote to select di candidate wey go fly di party for 2023 general election.

BBC Pidgin speak wit Sobeye Eli wey be lawyer and APC member for Rivers state to torchlight di presidential aspirant race for di ruling party.

And dis na how him explain di matter for us.

Di south west next to di north west na di biggest stronghold of APC in terms of di number of delegates wey go attend di national convention.

"Na natural tin as di party get stronghold dia, more hands go wan come on board.

"If you look di profile of di aspirants a lot of dem get experience in leadership for different levels.

"E dey difficult to predict for politics but by and large APC delegates go look at a few factors.

"Di outgoing president Muhammadu Buhari get important role to play if you wan read my mind dat na wetin go happun.

"By di time dem reach Abuja and di president moderate e go dey clear wia di whole tin dey go."

As per prediction, di president don already give hint for interview wey im do wit tori pipo Channels e tok two tins

E say di pesin wey go succeed am go be younger pesin.

"Di second tin wey e tok na say him no go name im successor," Sogbeye tok

For me di president go play major role to determine who go pick di ticket and di direction of wia di delegates vote go go.

Nigeria ruling party All Progressives Party (APC) don set dia presidential primaries for May 30-31.

We go dey update dis tori wit more aspirants profiles as dem dey come out one by one to declare dia intention.