You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Abba Kyari wife: Accused police officer wife faint for court as judge adjourn husband case
Small drama happun for di Federal high court for Abuja on Monday afta dem adjourn till 28th of March for ruling on di bail application wey di suspended deputy commissioner of police Abba Kyari and four oda police officers dem file.
Di first wife of di suspended Deputy Commissioner of Police, DCP, Abba Kyari, Ramatu on Monday, faint for Federal High Court, Abuja.
Na on March 8, Kyari and four oda police officers bin plead not guilty to eight count charge of conspiracy, obstruction, and dealing in cocaine worth 17.55 kilograms and unlawfully tamper wit 21.25kg worth of cocaine.
Kyari wife faint afta di trial judge, Justice Emeka Nwite, postpone di ruling on applications wey DCP Kyari and six odas file say make dem dey released on bail pending di determination of di case against dem.
How Abba Kyari wife faint for court
Kyari wife slump for ground as armed NDLEA officers dey try cari kyari away from di courtroom afta di trial judge, Emeka Nwite adjourn ruling on Kyari and four odas bail application to 28th of March, 2022.#
Kyari wife bin wear black cloth and bin hold her husband hand as dem stand close to di elevator wey dey di fifth floor of di Federal high court - but before you know, she come fall for ground and appear lifeless for ground.
Some good Samaritans come shaperly rush her inside one office for third floor of di court - and Abba kyari go inside wit am as dem try to revive her.
While she dey inside di office, one of di pipo dia rush to go get her inhaler as relatives dey shout say she dey asthmatic and need inhaler sharp sharp.
End of Di one wey oda users dey read well well
While dem dey try wake her up, armed operatives of di NDLEA, wey bin dey lead Kyari and the odas away from di court premises stand for di door area .Na afta she come get beta, di NDLEA official come lead kyari comot for court.
Some relatives wey yarn wit BBC Pidgin say she dey asthmatic attack.
Who be Kyari wife?
According to tori, Ramatu Yakubu na di first wife of Abba Kyari
She be Christian wey come from Gatungo, Gombe state.
She and Abba Kyari don dey married for 21 years and dem get three children togeda.
Wetin else happun for court on Monday?
Justice Emeka Nwite afta im hear argument on Mahmoud Magaji say di offence wey dem catch Abba Kyari for na bailable offence.
Kyari lawyer also argue say Kyari need time for im counsel to discuss wit am freely and prepare am for im defence for court and dat if im dey for NDLEA hand, dat one no go fit dey possible.
E say di NDLEA neva give am enough time to relax and reason im case well well and dat as e be now, im rights need to be protected.
Di lawyer of di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, Joseph Sunday ask di court to deny di suspended Deputy Commissioner of Police, Abba Kyari, bail.
Di agency for 21 paragraph counter-affidavit wey dem lodge before di court, insist say Kyari posed a flight risk - dis wan mean say e fit interfere for di case .
NDLEA also tell court say Kyari, wey head di Police Intelligence Response Team, IRT, fit escape from di kontri and make himself unavailable for trial, if dem release am from custody.
Di judge come adjourn di case for further hearing.
How Abba Kyari NDLEA mata take happun
NDLEA allege say di mata start on Friday, January 21, 2022, wen DCP Kyari make call to one of di NDLEA officers for Abuja for 2:12 pm. Wen di officer return di call two minutes later, Kyari inform am say e dey come to see am to discuss one operational mata afta Juma'at service.
"E show for di agreed venue of di meeting with di officer and go straight to di koko of di mata.
Na like dis: Im team bin gbab and arrest some traffickers wey come into di kontri from Ethiopia with, according to am, 25kg of cocaine.
E propose a drug deal wia im and im team go take 15kg of di cocaine and leave 10kg for di prosecution of di suspects wey dem arrest with di illicit drug for Enugu. In di meantime, di cocaine wey dey dia hand go dey replaced wit fake one wey worth 15kg. E ask di NDLEA officer to ask im men for di FCT Command, to play along too."