Lupus cause: Nollywood actress Kemi Afolabi say she get five years to live sake of di disease - See odas wey get am and wetin you need to know

Wia dis foto come from, KEMI AFOLABI/INSTAGRAM
Nollywood actress Kemi Afolabi don tok say her doctor tell am say she get five years to live and she don already live one year out of am.
Di popular actress reveal dis for one video interview she grant Nigerian media personality, Chude Jideonwo.
Afolabi tell Jideonwo say dem diagnose am with lupus and di disease no dey curable. She say she don dey manage di disease since she dey diagnosed wit am.
For inside di video, Afolabi break down in tears as she dey share her tori.
Nigerians on social media don chook mouth for di mata since di actress make di big revelation.

Wia dis foto come from, KEMI AFOLABI/INSTAGRAM
Who be Kemi Afolabi?
Kemi Afolabi na actress, script writer, movie producer and director.
Di popular actress read Law for di University of Lagos, Akoka.
Afolabi don act many movies and some of dem na Obinrin Ale, Oreke Mulero, Omo Pupa, Ayomi, Omo Mi, Jenifa, and Gold Statue.
End of Di one wey oda users dey read well well
So wetin be dis disease?
Well according to UK National Health Service, lupus na long-term condition wey dey cause joint pain, skin rashes and tiredness. E no get cure, but di symptoms fit improve if treatment start early.
Lupus fit go from small to serious.
On how e dey affect di body, e fit be small: Joint and skin problems and tiredness.
Moderate symptoms fit be Inflammation - swelling of oda parts of di skin and body, including your lungs, heart and kidneys.
Serious effect of lupus fit cause Inflammation - swelling, causing severe damage to di heart, lungs, brain or kidneys and e fit be life threatening.
Oda celebrities wey get Lupus
Selena Gomez

Wia dis foto come from, Selena Gomez
Popular American singer Selena Gomez tok for 2015 say she bin leave music for sometime after dem tell am for hospital say she get Lupus.
Na 2013 di news first come out about her health wen she cancel di music tour wey she suppose go for Asia and Australia.
Many report bin claim say na drug dey disturb am.
Di disease spoil her kidney so tey dem replace am for 2019.
Nick Cannon
Popular American actor Nick Cannon also get Lupus.
Na for 2012 dem tell am say im get di disease. Di disease spoil im kidney and im bin get blood clots for im lungs.
Im still dey alive despite di disease.
Toni Braxton
American singer Toni Braxton bin announce for 2011 say she get lupus. Na since dat time she don dey create awareness on di disease.
Toni na 54 years of age.












