Sunday Igboho released: Yoruba nation activist don 'free' to go hospital for Benin Republic

Sunday Igboho

Wia dis foto come from, SAIF

Goment of Benin Republic don release Yoruba Nation Activist, Chief Sunday Adeyemo, alias Sunday Ighoho to allow am go hospital.

Benin authorities release Igboho on Monday to im doctors under agreement say im no go leave di hospital or Cotonuou for any reason.

One Yoruba Leader and Leader of di Umbrella body of Yoruba Self-determination Groups, Ilana Omo Oodua Worldwide, Professor Banji Akintoye and one French Language Expert/ Deputy Alana of Ilana Omo Oodua Worldwide, Professor Wale Adeniran, na im dem handova Igboho give.

According to one of Igboho lawyer, Yomi Aliyu, wey confam news of in release to BBC, one oda Yoruba personality make dis medical release possible na Professor Wole Soyinka.

Inside statement wey di Communications Secretary to Ilana Omo Oodua Worldwide, Maxwell Adeleye release, Akintoye describe Ighoho release as "triumph of truth ova darkness for Yoruba land.

How Sunday Igboho land detention

Di Cotonu Court of Appeal sentence bin send di Yoruba activist Sunday Igboho go jail on top accuse say im dey associate wit criminals.

For July 2021, Di Cour D'Appel De Cotonou bin order make di Yoruba Nation agitator, Sunday Adeyemo remain for detention facility pending further investigation on top charges wey border on criminal association.

Im lawyer, Hounvenou Raphael bin explain say no be Nigeria goment sama am dis charges but na di Benin Republic goment dey accuse am say e dey plan to perpetrate some crimes for di kontri.

Association of criminals na di only accuse di Benin authorities dey accuse di Yoruba nation activist for.

Na on 19 July, 2021 authorities gbab di Yoruba activist for Cotonou, Benin Republic.

Dis arrest happun weeks afta Nigeria secret police, di Department of State Security Services, DSS bin declare Igboho wanted for allegedly stockpiling arms, allegation wey e don deny since.

BBC Pidgin find out from pesin wey close to di case say dem arrest Sunday Igboho around 2:00am for Cotonou on Monday through joint operation.

Benin Republic authorities later release im wife afta dem appear before di Cour D'Appel De Cotonou on July 22.

Igboho dey always organise protest and attend dem, many times wit support of pipo in di area
Wetin we call dis foto, Igboho dey always organise protest and attend dem, many times wit support of pipo in di area

Who be Sunday Igboho?

Na popular Yoruba activist, im real name na Chief Sunday Adeniyi Adeyemo.

According to reports im grow up for Modakeke area for Osun state, south-west Nigeria but im hometown na Igboho wey dey for Oyo State.

During im early days for Modakeke, Oga Sunday bin dey do mechanic work for dia.

Sunday Igboho

Im become popular during di former Oyo state govnor Rashidi Ladoja impeachment wahala for di support wey im give di Govnor.

Oga Igboho bin give herdsmen seven days quit notice to leave di Yoruba-speaking Oyo state for southwest Nigeria afta im accuse dem say na dem dey behind di security palava for di town.

As per family life Oga Igboho marry two wives but im no dey leave wit any of dem for im mansion for Ibadan.

Sunday Igboho become popular wen e begin fight for di secession of di Yorubas, one of the major tribes for Nigeria

To many pipo for southern Nigeria - especially Yorubas - Igboho na hero wey dey fight for dia dignity and protection.

But some oda pipo go disagree.

Make we torchlight di major tins wey don happun for Igboho life or wey happun because of am, since e come out to lead campaign in favour of di Yoruba tribe.

Many pipo from south western Nigeria say dem support Igboho
Wetin we call dis foto, Many pipo from south western Nigeria say dem support Igboho

See timeline of events wey shape Igboho life as Yoruba nation activist

1 October, 2020

Adeyemo aka Igboho comot to do protest under di Yoruba Nation banner on Nigeria independence day.

Although im don dey already dey do im activist work before, na now afta dis rally, more Nigerians begin ask who Igboho be,

22 October 2020

Igboho enter one forest for Kishi, Oyo State, to raid Fulani herdsmen im allege say dey responsible for kill-kill and kidnappings for di area.

15 January 2021

Igboho give seven days deadline to herdsmen to comot Oyo on top accuse of kidnap, rape and killings of farmers and pipo for di state.

E warn say e go come chase dem away if dem no comot afta di 7-day ultimatum.

26 January 2021

Reports comot say some faceless hoodlums attack di Soka residence of Igboho for Ibadan and burn di house.

26 February 2021

Kasala burst along Lagos-Ibadan expressway on Friday as police and Department of State Services allegedly try to arrest di Yoruba activist.

Tori be say Sunday Igboho bin go meet Yoruba socio-political group, Afenifere chief, Ayo Adebanjo wen di kasala burst.

21 March, 2021

Nigeria Armed Forces deny say dem dey "spy" on Igboho afta one video comot wey allege say soldiers dey monitor am.

15 May, 2021

Igboho and oda Yoruba Nation pipo hold peaceful rally for Osun State even as supporters from oda States like Kwara and Kogi, come to join di waka.

Igboho appeal to di police for Oyo State to release some Yoruba youth wey dem arrest for Ibarapa area of di State and warn say big rally go follow if di release no happen.

30 June, 2021

Yoruba Nation group announce 'mega rally' wey dem wan do to promote dia agenda say make Yoruba pipo breakaway from Nigeria to form dia own kontri.

Dem plan to hold di rally on 3rd July, 2021, for Gani Fawehinmi Freedom Park, Ojota, Lagos State

1 July, 2021

DSS raid Igboho main house for Ibadan, Oyo State.

Di secret police announce say dem kill two men, arrest 13 odas, confiscate weapons and passports, but say Igboho escape.

Many big-big pipo, including one sitting govnor for southern Nigeria. condemn di attack.

Igboho announce say di Lagos rally dem bin plan don dey cancelled for "safety" reasons.

3 July, 2021

Di Yoruba Nation go ahead to happun for Lagos but with heavy presence of anti-riot Police wey arrest some protesters.

Police also use teargas and water canon to pursue protesters for Ojota, Lagos

4 July, 2021

Lawyers wey dey represent Igboho, demand N500m payment and sorry message from di DSS, for di damage and wahala dem cause for dia client.

5 July 2021

Nobel Laureate Professor Wole Soyinka chook mouth for di mata and say di raid on Yoruba activist Sunday Igboho house by DSS dey unconstitutional and illegal.

E say if anytin, di goment suppose tell Igboho sorry becos di case dem tink say e get with am currently no hold water.

7 July, 2021

President Muhammadu Buhari hail di professional way security agencies handle di arrest of Nnamdi Kanu and raid of yoruba activist Igbogho.

E say security agents for di kontri "must be commended".